Big Brother Naija Season 5 housemates rules wey make di 2020 television reality show dey different

Big Brother Naija Show

Wia dis foto come from, Instagram- AfricaMagic

    • Author, Princess Igho Williams
    • Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
  • Read am in 2 mins

Big Brother Naija season 5 housemates and fans of contestants for Nigeria biggest television reality show don dey ginger to see brand new housemates wey go entertain dem dis year.

Organizers of di reality show dey tier rubber di season 5 of Big Brother Naija on Sunday 19th July around 19:00 West Africa Time but Coronavirus pandemic don make some ogbonge change dey for di 2020 edition.

Although di host go still be Ebuka Obi-Uchendu but some kain tins like di winner prize money and odas sake of di coronavirus pandemic go dey different dis time around.

Big Brother Naija

Wia dis foto come from, @Ebuka

Wetin we call dis foto, Former housemate of season four together with host Ebuka Obi-Uchendu

Wetin be di new rules sake of Covid19 wey make dis year show different from odas

Sake of di coroavirus pandemic wey dey affect kontries all ova di world, di organizers of di show don promise to obey and follow global best practices, precautions and preventive measures throughout di show. Dis na some of di changes wey viewers go see;

  • Dem no go allow guests to enta di BBNaija house or get physical contact wit housemates and di number of "ninjas" go also reduce
  • Di organizers say dem don cancel all audiences for live shows and evictions and di presenter go host di Sunday Live Eviction Shows for empty studio, crossing live into di Big Brother House.
  • Dia must be compulsory daily temperature checks for all production crew and guests to wey wan come di House.
  • Regular cleaning and disinfection of di House and production facilities especially surfaces/objects wey pipo dey use always

Oda changes wey make dis year edition of BBNaija different?

So many tins na im change for dis year edition of BBNaija starting from di audition wey dem do online only through Africa Magic website and di grand prize plus odas

Di winner of BBNaija season 5 go walk away with di biggest prize ever, value at N85 million. Di breakdown of di grand prize for BBNaija season five include:

  • N30m cash prize, two-bedroom apartment
  • SUV from Innoson Motors
  • Trip to Dublin, trip to Dubai
  • Trip to watch di UEFA Champions League finale
  • Home appliances
  • One year supply of Indomie noodles, Munch it chin-chin and Colgate toothpaste
  • One year supply of Pepsi
  • Branded chiller
  • Brand new Oppo mobile smartphone.
Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Meanwhile before di tier rubber of di show on Sunday, di organizers don test all di shortlisted Housemates and put dem for quarantine for 14 days, and and afta dey don clear all of dem, dey come permit di housemates to enta di house.