BBNaija reunion: See wen Big Brother Television show dey start and how di house mates slay for fans

Tacha and Mercy

Wia dis foto come from, official_mercyeke/symply_tacha

    • Author, Princess Igho Williams
    • Role, Broadcast Journalist, BBC News Pidgin
  • Read am in 2 mins

Fans of reality TV show Big brother Naija don dey set to hear gist about di reality of life outside di house from di former "Pepperdem" housemate.

Di big brother "Pepperdem" reunion show start on 1 June, and dem go dey show am from Monday to Thursday around 10:00PM on African Magic Urban and 10:30PM on 154 Africa Magic Family.

Among di 26 housemates wey storm di house 30th June 2019, fans dey look forward to see Tacha and Mercy and how di two go relate during di reunion.

Big Brother Naija

Wia dis foto come from, @Ebuka

Even di organizers - Africa Magic TV post tweet about di two housemate wey fans dey look forward to see.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Tacha and Mercy get plenti fans base during di reality show because of dia efizzy and quarrels wey later come make organizers of di show disqualify Tacha from di show.

Mercy na im come be di winner of di Big Brother Naija "Pepperdem" wey be di fourth season of di reality show. She be di first woman to win am.

Oda housemates wey fans of di show still dey look forward to see na; Sheyi, Mike, Ike, Cindy, Venita, Omosola, Jeff, Kim Oprah, Tuoyo, Kaffy, Elozonam, Frodd, Joe, Avala, Diana, Ella, Enkay, Esther, Gedoni, Isilomo, Jacky, Nelson Sir Dee, Thelma