Big Brother Naija 2020: Africamagic TV bbaudition don start - Dis na how you fit apply

Mercy Eke

Wia dis foto come from, Mercy Eke

Wetin we call dis foto, Mercy Eke go be di first woman BigBrother Naija
    • Author, Olaronke Alo
    • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin, Lagos
  • Read am in 1 mins

MultiChoice Nigeria don announce di di fifth season of dia popular TV Reality show, Big Brother Naija wey dem tok say e go start for July 2020.

Di organisers tok for statement wey dem release on Wednesday say dem go do 10 days online audition to select pipo wey go participate for di show. Di audition go start from May 20 and e go end for May 30.

Di contestants go record two minutes video of themselves to tok why dem suppose chose dem to dey part of di BB Naija season 5 housemate, na so di organisers tok for one Instagram post.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Di Chief Executive Officer of MultiChoice Nigeria, John Ugbe tok on di return of BBNaija.

"Big Brother Naija na one of Africa biggest entertainment exports outside Nollywood. Di Fifth season go be di biggest thing on African television in 2020." He tok.

He add am say dis show na one of di biggest showcase of Nigeria diversity.

Wit weeks of plenti drama, romance, Friday night games and di popular Saturday parties, di Big Brother Naija reality TV don produce ogbonge celebrities since e start di first edition for 2006.

Big Brother Naija don become Nigeria biggest reality TV show and many young pipo between 16 and 40 years dey follow di show wella.