BBNaija 2019 finals: Mercy na di first woman Big Brother Naija winner

Wia dis foto come from, Mercy Eke
Las las Mercy Eke don win di fourth season of di Big Brother Naija reality TV show.
Afta plenty drama, romance plus fighi fight, inside three months, Mercy ova take Mike wit 41 per cent to win di Big Brother Naija reality TV show.
Frodd, Seyi and Omashola chop eviction on Sunday night before dem announce di winner.
Di show wey begin on June 30 wit 26 housemates bin get five pipo wey become last pipo standing inside di contest for di winning prize on October 6.
Mercy go pack 60 million naira waka comot from di house. Ontop dis prize she go get 30 million naira cash, 25 million naira SUV from Innoson motors, trip to Dubai plus oda echetram echetram dem.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post
23 house mates chop eviction, Tacha chop disqualification in all.












