Big Brother Naija season 5 housemates contest dey start 19 July - See evritin to know about Nigeria biggest television reality show

Big Brother Naija season 5 housemates

Wia dis foto come from, Big Brother Naija

    • Author, Fiona Equere
    • Role, BBC News Pidgin

Di new season of Big brother Naija, Nigeria biggest reality television show go start on Sunday.

Na Ebuka Obi-Uchendu go host di show, Ebuka na former housemate of di show back for 2006 and na him don host di last three seasons wey be See Gobbe, Double Wahala and Pepper Dem.

Big Brother Naija season 5 go dey different because of di coronavirus wahala wey still dey worry di kontri.

But di organizers, Multichoice say dem don develop Covid-19 action plan to make sure say evribodi dey safe.

As per di title name of di season and di number of housemates, di organizers say dem go announce am during di live lunch show wey go kick off at 7PM Lagos time.

See evriytin you need to know about di new season of Big Brother Naija.

Big Brother Naija Show

Wia dis foto come from, Instagram- AfricaMagic

How Big Brother Naija season 5 go be?

Di new housemates wey dey enta di house no go observe social distancing. Dat na because dem don clear dem of any medical condition including Covid-19.

During di 10 weeks wey dem go stay for di house Big Brother go assign housemates task wey involve team play wey Big Brother know and di housemates need to find out.

Some of di general rules for di house na say di housemates no go get any contact with di outside world, no violence and dem must nominate dia fellow housemate for eviction.

Shower hour no go dey dis season according to di organisers. No be only dat one wey dem cancel for dis season.

No guest go dey allowed inside di BBNaija house or come in contact wit housemates.

Dem also reduce di number of ninja dem too and canel all audience for di live eviction show.

Ebuka go host di Sunday live eviction show for empty studio and den cross live inside di Bigbrother house.

How to Vote?

To keep dia favourite housemates for di housemates or to win di show, fans gatz vote.

And na four ways dem fit vote through; SMS, Mobile site, Desktop website, MyDSTV or MyGOtv APP for subscribers only.

How to watch Big Brother Naija season 5 show

Di Big Brother Naija season 5 go dey live 24/7 for on channel 198 for DSTV and channel 29 on GOtv.

While di live Sunday eviction go show for 7PM for African Magic Showcase (DSTV Channel 151), African Magic Urban (DSTV Channel 153), African Magic Family (DSTV Channel 154 and Gotv channel 2).

Wetin di winner go carry go house

Di big N85m winner's prize go include:

•Dubai trip for 2

•2 bedroom apartment

•N3Om cash prize

•Champions league finale trip, one year supply of pepsi, branded chiller

•OPPO RENO smartphone

•Innoson G40

•Trip to Dublin

•TV and Premium fridge

•Plus plenty other prizes

Wit weeks of plenti drama, romance, Friday night games and di popular Saturday parties, di Big Brother Naija reality TV don produce ogbonge celebrities since e start di first edition for 2006.