Amy Cooper: Franklin Templeton sack white woman wey call police say 'African American' man dey threaten am

Christian Cooper feem Amy Cooper after she refuse to stop her dog from running around di area

Wia dis foto come from, Christian Cooper

Wetin we call dis foto, Christian Cooper feem Amy Cooper after she refuse to stop her dog from running around di area
Read am in 2 mins

One white American woman wey call police afta one black man ask her to chain her dog for New York City don chop sack from her job with one investment firm.

Di man, wey dem say dey like to watch birds, bin dey concerned say di dog fit endanger wildlife for Central Park.

"I go tell dem [police] say one African-American man dey threaten my life," she tell am.

One video of di incident dem post ontop social media go viral on Monday.

Di woman, wey dem identify as Amy Cooper, later apologise, say she "overreact".

Ms Cooper also return di dog to one rescue centre after allegations say she manhandle di dog, as e be like say she bin dey choke di animal while she dey call di police.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Presentational white space

Di man, Christian Cooper (e no relate to her), bin posted di video of di incident ontop Facebook say di mata start wen e notice Ms Cooper dog dey run around one area of Central Park wey dem dey call di Ramble.

"Ma'am, dogs need to wear chain for di Ramble all di time. Di sign dey dia," Mr Cooper say e bin tell Ms Cooper, but she refuse to hold her dog.

Na so Mr Cooper begin to feem Ms Cooper with im mobile phone, and she asked am to stop.

Di video show Ms Cooper dey call di police, as she dey tell Mr Cooper say "I go to tell dem say one African-American man dey threaten my life."

Di video, wey Mr Cooper sister too post for Twitter, don make pipo para for social media as many begin tok about di high number of killings of black men by police for di US.

Others tok about di high-profile fatal shooting of Ahmaud Arbery, one 25-year-old black man wey bin dey jog wen two men kill am for February.

Ms Cooper employer Franklin Templeton, one investment firm, sack her afta dem investigate di incident, dem bin tok for Twitter say "we no dey condone racism of any kind."

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

The Ramble in Central Park is a popular area for bird-watchers and signs say dogs must be leashed

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Ramble for Central Park na popular area for bird-watchers and signs dey say owners must hold dia dogs

New York Police Department say nobody make complaints and dem no arrest anybody according to broadcaster NBC.

Ms Cooper bin tell di news outlet, "I sincerely and humbly apologize to everyone, especially to dat man, im family."

Di incident make her realise say no be everyone fit think of di police as "protection agency," she add.

She also return her dog to di Abandoned Angels Cocker Spaniel Rescue, wia she bin adopt am few years ago, afta di allegations say she choke di dog as she bin dey call di police.

"Di dog dey our hand and he dey safe and in good health," di organisation write for Facebook.