Coronavirus: Davido say im fiancée test positive for Covid-19

Davido and Chioma

Wia dis foto come from, Instagram/@davidoofficial

Read am in 1 mins

Nigeria music star David Adeleke, AKA Davido say im fiancée Chioma Rowland, don test positive to coronavirus.

Di musician announce am on Friday night, March 27, 2020, ontop im official Instagram page.

Im say although Chioma no dey show any symptoms, dem decide to test sake of dia recent travel history.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Di musician say di result of im baby, plus 31 oda of dia close associates come back negative.

BBC Pidgin Covid 19 graphics
BBC Pidgin Coronavirus slice

Davido say Chioma no dey show any symptoms for now, but she dey for quarantine while im don go into full isolation for a minimum of 14 days.