Coronavirus: Black skin fit protect you from Covid-19?

Wetin we call dis Video, Coronavirus: Black skin fit protect you from Covid-19?

You fit don dey see posts wey dey fly upandan for social media say black skin fit protect you from coronavirus.

Dat claim na lie.

No scientific evidence dey say black pipo get beta chance to fight di virus. Any pesin fit get coronavirus. And if you old or already get health wahala, dat one fit mean say your risk dey bigger for serious wahala or even death.