DR Congo Election delay afta two years delay

Wia dis foto come from, AFP
Vote counting dey on Monday afta Presidential election for Democratic Republic of Congowey happun on Sunday
Di first result fit land on Saturday January 5, according to election laws for di kontri.
But complain full ground say pleanti delays worri di election from say voter register no dey to electronic voting mechine wey no gree work for some areas.
Presidential election start Sunday morning afta two years wey authorities delay am.
Early morning rain dey delay votes for some areas. 21 candidates follow dey contest to be president.
Opposition candidates Martin Fayulu, Felix Tshisekedi and Emmanuel Shadary wey be former interior minister dey for top three wey follow dey contest.
About 40 million pipo qualify to follow vote for di African second largest kontri.

Wia dis foto come from, AFP
Constitution no gree make president Joseph Kabila follow contest di election again, im don dey for power since 2001.
End of Di one wey oda users dey read well well
Im suppose step down two years ago but authorities shift di election wey make clock seventeen years for power.

Plenti kasala tanda for di kontri since goment decide say make over 1.3 million pipo no go follow vote.
If di election waka well, e go be di first time di kontri go handover power according to di pipo vote.











