Atiku: 'All Nigerians no mata di political side must work togeda to sack Buhari'

Atiku Abubakar and Govnor Wike of Rivers State
Read am in 3 mins

Nigeria main opposition Candidate for di 2019 election Former Vice President Atiku Abubakar say di entire kontri must work togeda to comot di All Progressives Congress APC goment next year.

Atiku tok dis one wen im go tell Rivers State Governor Nyesom Wike thank you as dem host di PDP National Convention well.

Im say, "di entire kontri need a new goment. Definitely, we no need APC to return to power for 2019. Dis kontri don suffer plenti palava from recession, unemployment, insecurity and no unity but time don reach to follow new direction for di interest of di pipo."

Rivers State Governor, Nyesom Ezenwo Wike come say all PDP leaders and Nigerians wey get beta mind get duty to form one united front to sack di APC Federal goment comot for office. 

Atiku Abubakar
Wetin we call dis foto, Atiku Abubakar

Im say even though say different party leaders bin support different aspirants, as Atiku Abubakar don come out as di party Presidential Candidate, evri bodi must work togeda to save di kontri.

"We no get any oda party wey go fit save dis kontri apart from di PDP. As one candidate don come out, we get duty to see say di party take over. We be one family and we go do evritin to make sure say we no give APC any gap. Dem don fail Nigerians and we go take over for 2019." Na so Wike tok.

Former Ogun State Governor, Otunba Gbenga Daniel, Former Anambra State Governor, Peter Obi, PDP National Chairman, Prince Uche Secondus, Senator Ben Murray Bruce, Senator Sam Anyanwu, Former Deputy Speaker of the House of Representatives, Rt Hon Austin Opara and Edo State PDP Chairman, Chief Dan Orbih naim follow Atiku go di visit. 

How social media react to Atiku Abubakar afta PDP presidential primaries

As People's Democratic Party, PDP, name former vice president Atiku Abubakar as dia presidential candidate for di 2019 general election, Nigerians sharpely enta social media to chook mouth for di matter.

Many of dem believe say di former vice president na strong candidate wey fit challenge President Muhammadu Buhari wey be di presidential candidate for di ruling All Progressives Congress, APC, for election

For di primaries wey PDP do for Adokiye Amiesemaka stadium for Port Harcourt, oga Abubakar collect di highest number of votes from delegates to defeat eleven oda aspirants.

Many of im party members don congratulate am for im victory.

Wetin we call dis Video, Co-founder of di 'Bring Back Our Girls' campaign, Oby Ezekwesili, don declare to contest for president

But some Nigerians dey reason say di two main candidates na bad choice.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Some feel say di former vice presido to former president Olusegun Obasanjo get chance against Mr Buhari.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Some dey reason say pipo too dey spread bad rumour about oga Abubakar too much.

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 4

But eh, 2019 no far again and, to become president no be easy somtin.

Skip X post, 5
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 5