Aisha Buhari wan shake APC table?

Wia dis foto come from, Aisha Buhari
Aisha Buhari, wife of Nigeria president on Sunday post for all her verified social page dey bad-mouth APC wey be her husband party.
Inside di post, Mrs Buhari accuse ruling All Progressives Congress, wey be im husband party, say dem do wayo wella for most of di primaries di party do.
She even provoke for di APC National Chiarmo Adams Oshiomhole say im wey be 'Comrade/Activist' yet impunity-by force power dey happun under im watch.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Pipo wey see di post no believe am at first, some even dey wonda weda yahoo-yahoo boyz don hack her social media accounts.
BBC don call di presidency to confam wetin dey happun but no bodi don respond or reply text message on top di mata.
E fit be say na wetin happun to her brother for Adamawa State northeast Nigeria wia im loss di primary. Dat one make di president wife vex wella, according to wetin BBC Pidgin find out.
No be today she don begin vex or provoke for her husband goment. But dis na di first time she go bad mouth him politic party.
APC neva reply wetin she tok but dis one dey come just afta di ruling party declare her husband Muhammadu Buhari as dia 2019 presidential candidate.
End of Di one wey oda users dey read well well










