PDP Presidential Primaries: Oga Atiku Abubakar, welcome to di campaign - Keyamo

"Oga Atiku Abubakar, welcome to di campaign."
Na so President Muhammadu Buhari pipo take greet di tori say former vice president, Atiku Abubakar, na di candidate of main opposition People's Democratic Party, PDP.
Mr Atiku use 1,532 votes win oda pipo wey dey drag to win PDP ticket for dia convention for Rivers state, south-south Nigeria.
Oga Buhari sef don congratulate all di pipo wey win for All Progressives Congress, APC, primaries across di kontri.
Im wife, Aisha Buhari, bin post for Twitter wey she blast di party on top how dem arrange di primaries.
Tori be say her brother for Adamawa State northeast Nigeria, no win im own primary afta e spend money buy form.
But oga Buhari say losers suppose look Lagos govnor, Akinwunmi Ambode wey, even though e loose, e no abandon di party.

Wia dis foto come from, Festus Keyamo/Twitter
Festus Keyamo, tok-tok pesin for oga Buhari campaign organization, tok say Nigerians go choose weda dem wan follow pesin wey im way no pure or pesin wey im way clear like pure water.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Also, Nigeria Senate President, Bukola Saraki, don tok say di kontri neva ready for im own kind of leadership.

Wia dis foto come from, Bukola Saraki/Facebook
Oga Saraki loose di ticket of People's Democratic Party to Mr Abubakar for di convention.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Oga Saraki thank everybody wey support im vision and say ''maybe di kontri neva ready for am yet''.
Na oga Abubakar go face President Muhammadu Buhari for 2019 election as di main opposition candidate.
Mr Atiku score 1532 delegates votes to win di ticket, according to votes wey Ifaenyi Okowa, di chairman of PDP Convention committee announce.
Now, BBC News Pidgin understand say oga Atiku fit pick former Anambara State govnor Peter Obi from southeast as im vice.
Di former Vice Presido don already thank delegates wey vote am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Senate president Bukola Saraki wey lose to Mr Abubakar don congratulate am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4

End of X post, 5

Wia dis foto come from, Twitter/@atiku
Over 3274 delegates na im mark dia names to vote out of 4000 delegates wey suppose show for di convention.
Already, agents of di 12 aspirants don confam say di voting process dey pure.
Delegates wey vote
Di 12 candidates no step down for any.
Over 3274 delegates na im mark dia names to vote out of 4000 delegates wey suppose show for di convention.

Wia dis foto come from, Twitter/@OfficialPDPNig
Breakdown of delegates according to di states include:
Pesin wey go fit beat Buhari na im we want - PDP Delegates

Wia dis foto come from, Other
"We dey look for candidate wey go defeat President Buhari." Na so Dr. Princess Rabi Ibrahim from Zamfara state tok.
She say di candidate must be pesin wey no get any comma wey be say dem elect am today, tomorrow EFCC go come arrest am...
Balarabe Shehu Shuni from Sokoto say na young pesin wey go unite Nigeria and provide job for young pipo e want.
"Na di candidate wey go bring progress, tackle insecurity, bring employment for our youth and also move di kontri forward naim we want."

Wia dis foto come from, Twitter/@OfficialPDPNig
For Senator Thompson Sekibo from Rivers state, all di aspirants don serve for one capacity or do oda so dem get di experience to take lead di kontri well pass wetin dey now.
"We dey look for pesin wey be true Nigerian, wey respect human life, pesin wey don read and understand di constitution of Nigeria so e go lead and rule according to di law."
Olivia Dazyan from Plateau state and Setonji Koshoebo from Lagos dey hope say di candidate wey go come go dey dynamic, young and intelligent, pesin wey fit give credible leadership as e concern security and di economy because hunger dey.