Cameroon presidential election: Opposition candidates don di count fraud

- Author, Leocadia Bongben
- Role, BBC News Pidgin, Cameroon
- Read am in 4 mins
Some presidential candidates, Cabral Libii and Maurice Kamto don di cry say fraud for some parts for kontri even if deh vote for calm atmosphere for Yaounde.
Cabral Libii for Univere party weh e vote for 10:00am say all tin di pass fain and e representative dey for polling unit.
But e say sad news komot for diaspora, weh e representative no get access for polling station even though de bi give documents for ELECAM since.
For Buea e say mayor drive away dia representative weh e insist say make pipo vote with voter's cards and oda polling stations for Buea no open.
But ELECAM Southwest regional delegate, Mewanu Divine, tell BBC News Pidgin for Buea say e nova hear say drive away Univere representative.
For Far North Cameroon, Makari, Cabral say dia representative don see CPDM militants with about two hundred voters' cards. Den as deh tok de civil administration tell de pesin say if e no stop e go deal with e.
"We go do weti way we get to do, if deh try for steal de votes", Cabral tok.

For Maurice Kamto for Cameroon Renaissance Movement, CRM, for some polling units e papers don finish and deh no replace'am.
End of Di one wey oda users dey read well well

For Centre regions de stop CRM e representative for enta polling unit, for Maroua Salak tori na say some elements for Rapid Intervention Battalion, BIR di impose paper already for envelop for voters.
"Even for Belgium representative no bi fit enta polling unit ", Kamto tok. But e say e still be confident for seka say Cameroon popi don mobilise more dan before.
"We no want say small problem destabilise we kontri and ah di call de pipo weh deh di control de polling unit for play dia part for republican and democratic spirit for prevent kontri for get useless tension. We get correct occasion for show say wa kontri bi democratic", Kamto tok.

For Bamenda Prime Minister, weh bi member for ruling CPDM party say e don vote as citizen and e glad for do so, den e call for oda Cameroonians for do de same go vote.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
With de tension for Bamenda, security sources don confirm say deh kill two pipo weh deh suspect say na separatists forces weh deh bi wan stop pipo for go vote.
BBC tori pesin for Bamenda say e still see die bodi dem for front hospital as e di pass.

For Buea, gunmen attack motor for national newspaper, Cameroon Tribune, weh na only de driver bin dey inside, scatter de windscreen but e try run.

Wia dis foto come from, EPA
Tension bi dey for Aloe and Muea for Southwest but BIR succeed for push dem and all tin don calm down, ELECAM regional boss tok.
Laik all citizens president Biya vote for Ecole Publique Bastos and na for de same place weh Akere Muna weh e withdraw back Maurice Kamto vote.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

On Sunday 7 October, Cameroonians dem begin go file out on Sunday morning vote for de next president afta seven years.
About 6.7 million voters na im authorities dey expect to vote inside dis election.
Election Cameroon representative, Mr Bambia for polling unit tell BBC News Pidgin say wen voters kam deh di first check dia number for list.
Afta deh show dem de ballot papers, deh pickam den go vote kam back put ink do finger print den sign.

Polling centre for Efoulan, Yaoundé open for 8:00am and de first pesin vote for 8:05am.
Na for dis polling centre weh one of de candidates, Cabral Libii go vote small taim.
"Ah don perform ma civic duty, and na de tin weh ah preach and ah glad for bi de first pesin weh e vote", Pastor Efulekeng tell BBC News Pidgin.

Observer Behalal Anne for one NGO weh e partner with European Union, EU, say all tin di pass fain no complain for now. "All polling unit open normally and we hope say e go go on laik this till de end" e add.
For Northwest resident tell BBC News Pidgin say internet don finish and gun men attack for Bafut but army push dem back seize guns and petrol.

Anoda man "Ah glad as a say ah vote for de first taim and ah hope say ma vote go count and bring change for this kontri".
Any man weh e no kam vote na error e di make. If you wan make anything change na through vote.
One political party member for CPDM, Jean Oscar Manga say all tin di pass fain and deh di wait for voters.















