Cameroon presidential election: ELECAM go meet parties today as goment rubbish Kamto victory

Paul Biya for billboard
Read am in 4 mins

Vote counting commission and political party representatives go hold meeting with electoral body officials on Tuesday for Cameroon capital Yaounde as di vote counting commission begin sitting, goment CRTV dey report.

Dis meeting dey come as officials for election office (ELECAM) complete di first day of counting results of Sunday 7 October 2018 presidential election.

According to Cameroon law, only di Constitutional Council go fit announce results of Sunday vote afta two weeks.

Wia dis foto come from, PACOME PABANDJI

Wetin we call dis foto, Issa Tchiroma Bakary, na Cameroon Information Minister

Meanwhile Cameroon goment don dismiss claim by presidential candidate Maurice Kamto say e don win Sunday presidential election.

Issa Tchiroma Bakary wey be di kontri tok-tok pesin say make pipo no believe wetin Kamto tok as na di constitutional council be di only authority wey fit give result.

Tori be say one of Cameroon opposition presidential candidate Maurice Kamto on Monday evening claim say na him win Sunday election.

But di ruling People's Democratic Movement party don accuse Kamto say im dey break law unto say di election bodi never announce result.

Maurice Kamto voting
Wetin we call dis foto, Maurice Kamto di vote

Only constitutional council go announce results - Cameroon Minister

Before e make im victory claim, Cameroon Minister Territorial Administration Paul Atanga Nji warn say anyman weh e announce results wey no come from constitutional council go face de law,.

According to di kontri law book, na only di Constitutional Council go fit announce results of Sunday vote afta two weeks.

Minister e warning komot afta social media di put results as deh komot for polling units and even one party PAP congratulate one Maurice Kamto for Cameroon Renaissance Movement, CRM.

Also, BeretaNews weh na pro-separatist website claim say Maurice Kamto for CRM say e win elections and say na only useless election bodi fit change election for favour president Biya.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Cameroon

Wia dis foto come from, Facebook/President Paul Biya

Erik Essousse, Director for ELECAM, de organ weh e di organise lections for kontri say make all man bi patient for seka say de process for kontri no gree make deh publish trends.

E congratulate all man weh e bi involved for de process especially de ELECAM members for de work weh deh do.

Voting go with no problem except for some polling stations weh deh work under security and weh some party member get ballot for oda parties, et tok.

Electoral material reach all place for correct taim, and na 6,600,000 pipo bin register for vote for 24,988 polling stations.

African Union no observe vote for Anglophone region

Maurice Kamto voting
Wetin we call dis foto, Maurice Kamto di vote

Cameroon wake up Monday dey wait for results to know who win Sunday presidential election.

Tori be say ome katakata bin happun for di Anglophone region, even internet varnish liak soap for di Northwest region during election.

Afta voting for morning taim, counting of ballot start for 6:00pm on Sunday

BBC News Pidgin understand say de still di count votes dem and na only afta 15 days weh Constitutional Council go fit declare de result as de law tok.

Afta voting for morning taim, counting of ballot start for 6:00pm on Sunday
Wetin we call dis foto, Afta voting for morning taim, counting of ballot start for 6:00pm on Sunday

African Union - AU weh deh observe elections say deh no get results from Anglophone regions but say deh check say de result bi positive.

AU say de election bi positive but for some parts for Anglophone region pipo no vote and even for Yaounde de vote bi slow for some areas.

'From de results weh we get deh no tok anytin about de two regions but we check say deh result so far bi positive,' Kwesi Agbefia Seleagodji Lononyo head of African Union observer mission tell tori pipo.

De head of mission no tok if dis go affect de election outcome as deh no get results for de two regions.

"We no get any representative for Northwest so we di wait, no results from de two regions but we check say election bi positive", Kwesi Agbefia Seleagodji Lononyo, African Union head of mission tok.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

But for wen we see say out of de normal 2343 polling units for Northwest deh reduce'am for 79 polling units because of insecurity, and pipo no get means for komot from one village go vote for anoda.

Even pipo weh deh get voters card for de region lock dia doors stay inside house for seka say dey di fear.

"If we komot Ambazonia pipo go cut wa head, so weh just dey we for house", mami for Kumbo, Northwest tell BBC News Pidgin.

Wetin we call dis Video, Cameroonians di judge how di election process deh go

Jean Paul Yamnyuy, Elecam representative for Jumping Jack Group C say turn out be low, out of about 320 for list na only 169 vote.

"All tin pass fain and de result weh a get show say Maurice Kamto win by 67 votes and Paul Biya follow with 6o votes" e tok.

As counting start voters kam back for control dia vote and deh say dis taim, "man no make erreur' say deh go protect dia vote.

"We get for get the result so dat weh den wan officially give de results we fit march de result with weti weh we get", Collins Berynyuy tell BBC News pidgin.

President Paul Biya and seven odas na im contest di election and many dey expect Biya wey don rule for 36 years to win again.

Wia dis foto come from, Facebook/President Paul Biya

Wetin we call dis foto, President Paul Biya and seven odas na im contest di election and many dey expect Biya wey don rule for 36 years to win again.

But so far, observer Christophe Bobiokono say deh problem weh some pipo get na say deh no see dia names for polling unit and deh go back deh no vote.

E add say some Anglophones weh deh run from some regions no bi fit vote because de de law say deh only get to vote where they registered.