National Assembly go resume sitting on Wednesday afta Saraki, Dogara survive resumption day

Lawmakers go resume sitting on Wednesday to consider some issues like di amendment to di electoral act and INEC budget.
Tori as e dey hot be say dat leadership change inside di National Assembly fit no happun again as e be like say lawmakers from both parties don agree work for di unity of kontri.
Nigeria Senate President Bukola Saraki, House of Reps Speaker Yakubu Dogara survive dia positions for Day One afta di kontri National Assembly reopen for business.
No drama happun on Tuesday in fact BBC Pidgin fit report say evri-evri waka normal wen di lawmakers begin sit afta more than two months holiday.
Senate adjourn Tuesday sitting to honour di death of one member from Kwara.
Dis one different from tori for town before now say na how Saraki and Dogora go survive as dem don port go opposition na im go be di koko of wetin go happun as dem resume.

Di only tin wey happun na say before dem go start sitting, di legislative aides begin protest for morning di allowance dem wey dem neva pay dem.

Wia dis foto come from, SHIRAZ CHAKERA
Wetin pipo bin expect on Tuesday?
Plot to remove Saraki and Dogora inside di upper and lower house sake of dia defection to opposition Peoples Democratic Party as well as 2019 budget proposal na di main tin wey go take centre stage, according to wetin politicians bin dey tink.
End of Di one wey oda users dey read well well
Already, Ahmed Lawal wey be Senate Leader threaten for national convention of di ruling All Progressives Congress on Saturday say dem go remove Saraki wen dem resume.

Wia dis foto come from, AFP
Bukola Saraki fit loss im post as Senate President wen di senate re-open sitting, according to sabi pesin tell BBC News Pidgin on Tuesday August 1, 2018 di day Saraki port from di ruling All Progressives Congress go main opposition Peoples Democratic Party - PDP
Sogbeye Eli wey be pesin wey sabi di law and know wetin dey shelle for APC caucus say 'in fact wen dem resume, katakata go burst on to say APC don plan finish to remove am dat day'.
'I see big fight wey go happun on dat day wen dem enta senate, because APC senators no go wan carri eye see am sidon on top chair as Senate President, now wey im no be dia member again'.
'Dem go apply supreme court judgement on top 'PDP against Adegunde' join section 68 of Nigeria constituion take pursue Saraki comot office' Sogbeye Eli tok
As e be say dem no allow tori pipo enta inside dia chambers on Tuesday no bodi know wetin dey road, until dia next sitting.











