You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Osun Election 2018: Dem don bring torchlight and candle to kontinu vote count for Osun election
Dem don begin count votes for di different polling units for Osun State, south west Nigeria wia pipo dey vote to elect new govnor.
According to law, voting suppose end by 2pm and counting go start. Only pipo wey bin dey line before 2pm go fit vote, new pipo no fit enta line.
Election bodi INEC, sama dis warning sharp sharp for dia twitter account, about fake election results, before pipo go begin post wetin dem like.
Earlier, Nigeria Police bin arrest two pipo wey dem suspect say be vote buyers for Iwo local goment area of Osun State.
Police say dem catch dem wit N604,000 and say investigation dey on.
Voting dey on for Osun State south west Nigeria as dem wan elect who go become dia next govnor.
Security pipo full ground, from police to civil defence, immigration and even corpers.
Forty candidates dey contest who be di next govnor for di state.
End of Di one wey oda users dey read well well
All Progressive Congress APC candidate Isiaka Oyetola don cast im vote L.A. school, Popo, Iragbiji LGA.
'Dancing Senator' Ademola Adeleke wey be one of di contestants from Peoples Democratic Party PDP don already vote for im polling unit for Ede LGA.
Afta e cast im vote Adeleke tell tori pipo say "all di allegation wey dem dey put on top my head na lie, di ruling party dey afraid of me, dem no wan, make I participate".
Madam Amudat Aweni Adeoti wey be di mama of ADP candidate Moshood Adeoti don cast her vote for Post Office ward 12, Gidigbo, Iwo, Osun state.
Voting dey go on for Ife East, Moore wia former deputy govnor Iyiola Omisore suppose vote.
BBC reporters wey dey ground for Osun say plenti pipo don show to follow vote.
Pipo wey dey sell food use di opportunity dey make some money.
Minister for Health Isaac Ademola dey ready to cast im vote.