Osun Election 2018: Dem don bring torchlight and candle to kontinu vote count for Osun election

Osun election
Read am in 2 mins

Dem don begin count votes for di different polling units for Osun State, south west Nigeria wia pipo dey vote to elect new govnor.

According to law, voting suppose end by 2pm and counting go start. Only pipo wey bin dey line before 2pm go fit vote, new pipo no fit enta line.

Election bodi INEC, sama dis warning sharp sharp for dia twitter account, about fake election results, before pipo go begin post wetin dem like.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Earlier, Nigeria Police bin arrest two pipo wey dem suspect say be vote buyers for Iwo local goment area of Osun State.

Police say dem catch dem wit N604,000 and say investigation dey on.

Voting dey on for Osun State south west Nigeria as dem wan elect who go become dia next govnor.

Osun

Wia dis foto come from, @PoliceNG

Wetin we call dis foto, Dem neva tok which political party di men dey work for

Security pipo full ground, from police to civil defence, immigration and even corpers.

Forty candidates dey contest who be di next govnor for di state.

All Progressive Congress APC candidate Isiaka Oyetola don cast im vote L.A. school, Popo, Iragbiji LGA.

Isiaka Oyetola
Wetin we call dis foto, Oyetola don vote

'Dancing Senator' Ademola Adeleke wey be one of di contestants from Peoples Democratic Party PDP don already vote for im polling unit for Ede LGA.

Ademola Adeleke
Wetin we call dis foto, Ademola Adeleke dey cast im vote

Afta e cast im vote Adeleke tell tori pipo say "all di allegation wey dem dey put on top my head na lie, di ruling party dey afraid of me, dem no wan, make I participate".

Madam Amudat Aweni Adeoti wey be di mama of ADP candidate Moshood Adeoti don cast her vote for Post Office ward 12, Gidigbo, Iwo, Osun state.

Voters
Wetin we call dis foto, Plenti pipo don show to follow vote

Voting dey go on for Ife East, Moore wia former deputy govnor Iyiola Omisore suppose vote.

Pesin wey come vote
Wetin we call dis foto, Voting dey go on for Osun state

BBC reporters wey dey ground for Osun say plenti pipo don show to follow vote.

Woman wey dey sell food
Wetin we call dis foto, Pipo wey come vote buy food to chop

Pipo wey dey sell food use di opportunity dey make some money.

Isaac Adewole
Wetin we call dis foto, Plenti Ogbonge goment oga dem follow dey vote

Minister for Health Isaac Ademola dey ready to cast im vote.

Corper
Wetin we call dis foto, Na Poll Officers wey be corpers go announce di result for dia polling unit