Osun 2018: Fire for fire as governorship candidates jam for BBC Yoruba debate

Osun Govnorship Debate

Four candidates jam for di BBC Yoruba governorship debate wey happun Friday for Osun state south-west Nigeria.

Aspirants from SDP senator Iyiola Omisore, ADP Olalekan Adeoti, APC Gboyega Oyetola and ADC candidate Akinade Akinbade ansa qweshion from pipo wey show s.

PDP candidate senator Ademola Adeleke no show.

Pesin wey dey ask qweshion.
Wetin we call dis foto, Pipo ask di candidates plenti qweshions

More than 40 pipo dey drag to become di next govnor but tori be say di battle na between dis five candidates.

Di candidates get opportunity to clear pipo dia mind on top how dem go push di state forward if dem win.

Akinbade wey be di first pesin to show before any of di oda candidates say if e win im goment go dey based on "transparency accountability and due process"

Akinade Akinbade
Wetin we call dis foto, ADC Akinbade don serve for goment before

"We no go award contract for di state without due process, I go award contract to pipo wey dia money small pass"

"We no go tolerate corruption, you no go fit thief hide" na so Akinbade tok.

Wetin we call dis Video, Codeine addiction: Wia Nigeria dey now - BBC Pidgin town hall debate

Ontop di plenti money wey di state don borrow Oyetola wey hope to continue wey di present govnor Rauf Aregbesola stop, say to borrow na normal tin.

APC candidate Gboyega Oyetola.
Wetin we call dis foto, Oyetola be Chief of Staff to di present govnor Rauf Aregbesola.

"E dey good to borrow for di good of di state, if we no borrow we no go fit achieve"

"Ontop salaries wey di state dey owe, we make decisions weda to sack or retain pipo. We don dey pay and we no go stop." Na wetin Oyetola tok be dat.

Former deputy govnor of Osun state Iyiola Omisore wey cause drama wen e waka join di debate more dan 1 hour late say e go run e goment with policy if e win.

Iyiola Omisore
Wetin we call dis foto, Iyiola Omisore dump PDP to go SDP

"We go bring back bursary and scholarship, we go work with WAEC and NECO to arrange calender to favour our students. Na so Omisore tok.

Adeoti tok about di Education standard for di state.

Olalekan Adeoti.
Wetin we call dis foto, Adeoti dump APC to contest under ADP

"No be di number of students wey dey fail be di Koko, all di states wey dey do well pass Osun get wetin dem dey do."

"Ontop di issue with LAUTECH, Oyo and Osun go need to join hand to make am beta." Na so Adeoti tok.

Political parties dem and di pipo of Osun dey prepare, round up campaign to go election vote dia new govnor on Saturday September 22.

'Dancing Senator' Ademola Nirudeen Adeleke wey go represent PDP for Osun govnorship election no show for di BBC debate

Wia dis foto come from, Twitter/@IsiakaAdeleke1

Wetin we call dis foto, 'Dancing Senator' Ademola Nirudeen Adeleke wey go represent PDP for Osun govnorship election no show for di BBC debate

More than 40 pipo dey drag to become di next govnor for di September 22, 2018 Election.