Nigeria Election: INEC say Permanent Voters Card go dey ready by May

Woman wey dey vote with electronic voting machine wey INEC official dey help for Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria plan to hold dia next general election between February and March 2019
Read am in 1 mins

Di Independent National Electoral Commission INEC, wey dey arrange election for Nigeria, don assure all voters wey don register say dem go get dia Permanent Voters Card by di first week of May.

INEC Chairman Professor Mahmood Yakubu make di promise on Monday for one meeting with Civil Society Organizations inside Abuja to plan di Ekiti and Osun states Governorship and 2019 General Elections.

Di meeting dey also chook eye for di voters registration wey still dey continue ahead of next year election.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post