INEC: Voters registration no dey end January 31

Voters registration cards.

Wia dis foto come from, Iinec nigeria/facebook

Wetin we call dis foto, Di commission say dem go announce di date wey di registration go end.
Read am in 1 mins

Di join-bodi for election mata for Nigeria wey be Independent National Electoral Commission (INEC) don deny claim wey dey go round say voters registration for Nigeria go end for 31 January 2018.

People bin dey fear say INEC wan end di registration sharp-sharp so dat plenty citizens no go fit vote.

Na for social media di commission enter to clear di claim wey dem say na fake and e dey deceive people.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Di commission write say di registration go continue until dem announce di date wey e go end wey go be later dis year.

Registration don dey go one for people wey go like vote for di 2019 general elections.