You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Osun 2018: Fire for fire as governorship candidates jam for BBC Yoruba debate
Four candidates jam for di BBC Yoruba governorship debate wey happun Friday for Osun state south-west Nigeria.
Aspirants from SDP senator Iyiola Omisore, ADP Olalekan Adeoti, APC Gboyega Oyetola and ADC candidate Akinade Akinbade ansa qweshion from pipo wey show s.
PDP candidate senator Ademola Adeleke no show.
More than 40 pipo dey drag to become di next govnor but tori be say di battle na between dis five candidates.
Di candidates get opportunity to clear pipo dia mind on top how dem go push di state forward if dem win.
Akinbade wey be di first pesin to show before any of di oda candidates say if e win im goment go dey based on "transparency accountability and due process"
"We no go award contract for di state without due process, I go award contract to pipo wey dia money small pass"
"We no go tolerate corruption, you no go fit thief hide" na so Akinbade tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
Ontop di plenti money wey di state don borrow Oyetola wey hope to continue wey di present govnor Rauf Aregbesola stop, say to borrow na normal tin.
"E dey good to borrow for di good of di state, if we no borrow we no go fit achieve"
"Ontop salaries wey di state dey owe, we make decisions weda to sack or retain pipo. We don dey pay and we no go stop." Na wetin Oyetola tok be dat.
Former deputy govnor of Osun state Iyiola Omisore wey cause drama wen e waka join di debate more dan 1 hour late say e go run e goment with policy if e win.
"We go bring back bursary and scholarship, we go work with WAEC and NECO to arrange calender to favour our students. Na so Omisore tok.
Adeoti tok about di Education standard for di state.
"No be di number of students wey dey fail be di Koko, all di states wey dey do well pass Osun get wetin dem dey do."
"Ontop di issue with LAUTECH, Oyo and Osun go need to join hand to make am beta." Na so Adeoti tok.
Political parties dem and di pipo of Osun dey prepare, round up campaign to go election vote dia new govnor on Saturday September 22.
More than 40 pipo dey drag to become di next govnor for di September 22, 2018 Election.