You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Codeine addiction: Wia Nigeria dey now - BBC Pidgin town hall debate
Many months afta di documentary wey BBC Pidgin and Africa Eye do wey touchlight codeine addiction, come shake ground well-well for Nigeria, many pipo gada for to see how tins be as per di fight against dis drug addiction.
For Afe Babalola Hall of di University of Lagos, Akoka, BBC Pidgin do town hall meeting wey young pipo follow goment health agency pipo, musician, and pharmacy association and tori pipo chook mouth on top wetin dey ground now as e concern codeine abuse.