You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Senator Adeleke: Four days to Osun election, police wan cari PDP candidate go court
Nigeria Police say dem wan cari PDP govnorship candidate for Osun state election Senator Ademola Adeleke go court say im do wuruwuru for exam.
Dis one dey happun three days to di govnorship election for di state.
Police dey claim say di senator write NECO exam for Ojo/Aro Community Grammar School, Osun state and say e and four oda suspects get case to answer for dat exam.
Tori be say police bin arrest Adeleke and im broda Sikiru Adeleke wey follow am write NECO exam for 2017 wia police say dem do wuru wuru. Police say dem arrest Principal of di school Alhaji Aregbesola Mufutau and two oda teachers wey dem claim say dem helep di Adeleke's commit di crime.
As dat wan dey happun, West Africa Examination Council WAEC confam say Senator Adeleke wey some pipo bin cari go court say im no get WAEC certificate, follow write dia exam for 1981.
WAEC say im write dia exam for May/April for Ede Muslim High School Osun state.
Senator Ademola Adeleke dey popular for Nigeria unto say im sabi dance well well. Di senator dey do final political rally for Osun wen police announce say dem wan cari am go court.