Cardinal McCarrick: Sex palava make catholic archbishop resign comot College of Cardinals

Wia dis foto come from, EPA
Pope Francis don accept di resign letter of popular US cardinal Theodore McCarrick wey dey face accuse say im sexually assault one teenager almost 50 years ago.
Di 88 year old former catholic archbishop of Washington don become di first man to comot di College of Cardinal.
Father Theodore McCarrick go do "penance and prayer" until im court case finish, na wetin Vatican tok.
For June officials for US Church say di accuse carry weight. But McCarrick say im "no remember" di abuse wey dem accuse am of.
Since den more allegation don comot.

Wia dis foto come from, Reuters
Di 88 year old na one of di most popular US cardinals and one of powerful Catholic leaders to face abuse accuse.
Wetin Vatican tok?
For statement, di Vatican say Pope Francis don accept McCarrick resign letter from di cardinalate and dem don order im suspension from di exercise of public ministry.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di statement also say dem don isolate am "for life of prayer and penance until im judge im matter for court ".
As im resign im means say di titles dem of Cardinal and "your eminence" go comot from am na wetin tok for Twitter.











