#MeToo: Dem don charge Hollywood producer Harvey Weinstein wit rape

Wia dis foto come from, Reuters
Dem don charge ogbonge Hollywood producer Harvey Weinstein wit rape and oda count of sexual abuse wen involve two women.
Weinstein bin hand imsef over to police for New York, America where im suppose answer question ontop sexual misconduct.
Di #MeToo movement wey start to draw attention ontop di seriousness of sexual abuse and harassment start afta plenti women come out to accuse oga Weinstein say im sexually harass dem.
Some even accuse di ogbonge producer wey dem disgrace sake of rape.

Popular actress dem like Kate Beckinsale, Lysette Anthony and Gwyneth Paltrow dey among di pipo wey don point finger give Weinstein.
A statement from di New York Police Department say dem "arrest, process and charge" oga Weinstein "wit rape, criminal sex act, sex abuse and sexual misconduct for incidents wey involve two
women".
Di statement also thank di "brave survivors dem for di mind wey dem get to come out to seek for justice."
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem never release di details of di allegations and di pipo wey make di accusations.
Oga Weinstein don always deny say im touch anybodi without dia permission and dis go be di first time dem go charge am.










