South Africa: Jacob Zuma don resign

Wia dis foto come from, Reuters
After im talk say im no dey go anywhere, South Africa President, Jacob Zuma don finally comot office.
Zuma don dey struggle make im no comot as President since December 2017 when dem remove am as leader of di African National Congress, ANC.
Wahala be say dem dey accuse Zuma of corruption wey im dey deny. But e be like water begin finish from di back of im fish when di ANC elect im deputy and rival, Cyril Ramaphosa as new leader for December 2017.

Wia dis foto come from, Reuters
Wetin go happen now?
According to di constitution of South Africa, when President comot from office like dis, di deputy go take over. Wetin dis one mean be say, Ramaphosa fit become President of South Africa after dem swear am in on Thursday.






