Arsenal vs Liverpool highlights: How di Gunners beat di Reds 3-2 to top di Premier League table.

Wia dis foto come from, Getty Images
Arsenal beat Liverpool 3-2 to top di Premier League table on Sunday.
Di game happun for Emirates stadium.
Gabriel Martinelli score di first goal of di game afta 58 seconds - na di quickest wey Arsenal don ever score against Liverpool for di Premier League.
But Liverpool respond well and striker Darwin Nunez give dem di level wen e score Luis Diaz cross afta 34 minutes.
Saka restore Arsenal lead in first-half added time afta Martinelli break clear on counter-attack only for Liverpool to level once again eight minutes afta di break wen substitute Roberto Firmino, wey come on for di injured Diaz, fire beyond keeper Aaron Ramsdale.
Liverpool, wey feel say dem bin deny dem a penalty wen defender Gabriel get on encounter for di first half, feel a further sense of injustice wen Thiago Alcantara dey penalised for a challenge on Gabriel Jesus with 14 minutes remaining, Saka convert am from di spot.
Bukayo Saka penalty settle di interesting match and put Arsenal back on top of di Premier League with victory over Liverpool for Emirates Stadium.
Di game as e happun live
FIRST HALF:
End of Di one wey oda users dey read well well
Arsenal 0-0 Liverpool
1 min: Game start afta di players take a knee
Goal!
Arsenal 1-0 Liverpool
1 min: Arsenal don score wow! Na Gabriel Martineli.

Wia dis foto come from, Getty Images
VAR check for offside no upturn di goal. Di goal dey stand.
Martinelli just open up im right foot and just put di ball in. Liverpool team no believe am.
5 mins: Darwin Nunez get di ball but di Liverpool striker shot dey heavily deflected for a corner.
7 mins: Trent Alexander-Arnold corner dey booted away by Thomas Partey, wey start anoda Arsenal counter.
Gabriel Martinelli get di beating of Luis Diaz for pace and di Liverpool man bring am down on halfway. Yellow card.
7 mins: Darwin Nunez dey offside now as e try to run onto di ball forward. Dis na is only im third Premier League start.
9 mins: Arsenal keeper Aaron Ramsdale don injure.
E be like say e hurt imself while taking a goal-kick and den again as e run out of im box.
Matt Turner dey get ready.
10 mins: Matt Turner fit siddon back now. E be like Aaron Ramsdale go carry on..
11 mins: Liverpool corner afta a bad first touch from Gabriel Martinelli.
13 mins: Ben White go down di right and cross am to Granit Xhaka, but Alisson save am.
15 mins: Liverpool want penalty as Luis Diaz volley one cross against di arm of Gabriel, wey im arm dey out.
VAR decide not to get involved so no penalty.
17 mins: Now Arsenal fans no happy as Bukayo Saka collect for face from Konstantinos Tsimikas but no punishment dey for am.
19 mins: Takehiro Tomiyasu block Mohamed Salah from getting Jordan Henderson ball wey dey over di top.
21 MINS: Bukayo Saka find Gabriel Martinelli for di box but di Brazilian flash di ball across goal. Ben White keep am in but den di referee stop play because Trent Alexander-Arnold dey down.
23 mins: Di replay show Gabriel Martinelli stand on Trent Alexander-Arnold ankle afta crossing. Accidentally.
Di physios don come on.
23 mins: Dem don stop di play for di ankle injury.
Jurgen Klopp dey tok with Jordan Henderson. Mikel Arteta dey tok to some of im players but im own look like happy convo.
24 mins: Trent Alexander-Arnold dey back on now. E dey lucky say no be injury wey dey worse pass so.
26 mins: Mohamed Salah run down di right and e find Darwin Nunez. E blast in a shot from angle wey Aaron Ramsdale block and Diogo Jota no fit reach.
28 mins: Gabriel Jesus move past several players for di box but e no make proper contact with di shot and Alisson safe am.
30 mins: William Saliba almost equalise for Liverpool.
Arsenal defender get dia first before di Reds striker fit get on di end of a right-wing cross and put am back towards im own goal. But Aaron Ramsdale dey at alert.
32 mins: Mohamed Salah get di ball on di right wing, go between two defenders and den fire shot wey rolls into di side-net.
34 mins: GOAL!
Arsenal 1 - 1 Liverpool
Darwin Nunez score di equaliser for Liverpool.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Reds play one long throw wey Gunners defender Gabriel put in di path of Luis Diaz. E cross am and Darwin Nunez get di ball from close range to send am over Aaron Ramsdale.
36 mins: Luis Diaz dey offside as e run to di ball down di left but William Saliba defend am well.
37 mins: Thomas Partey wrestle Luis Diaz to di ground and di Liverpool player dey ground.
39 mins: Luis Diaz don collect treatment and di game continue although e be like e still dey in pains.
41 mins: Luis Diaz don go down again. Di physios don come on. E be like Roberto Firminho go replace Luis Diaz. Na im left knee dey worry am.
42 mins: SUBSTITUTION
Luis Diaz off and Roberto Firmino don come on.
45 mins: Bukayo Saka dey penalised for fouling Diogo Jota afta e initially head di ball past am.
45 MINS: INJURY TIME
Dem add five minutes more sake of VAR and injuries.
45 + 3 mins: Arsenal win dia first corner of di game.
Bukayo Saka take am but e dey headed away by Darwin Nunez.
45 + 4 mins: Arsenal skipper Martin Odegaard bring down Diogo and collect yellow card.
45 + 5 mins: GOAL!
Bukayo Saka score for Arsenal. Di gunners don take di lead again.
Gabriel Jesus beat Thiago to get di ball forward. Gabriel Martinelli run down di left and play di ball to Bukayo Saka, e slide di ball into an empty net for di back post.
HALF-TIME
Arsenal 2-1 Liverpool
46 mins: SECOND HALF
Arsenal 2-1 Liverpool
Second half don start.
48 mins: Gabriel Martinelli beat Joe Gomez but Bukayo Saka shot dey blocked.
Game don start!
50 mins: Gabriel Martinelli go past Joel Matip and find Martin Odegaard, whose powerful shot go straight to Alisson.
53 mins: GOAL!
Liverpool don equalise.
Diogo Jota feed Roberto Firmino with di ball. Di Brazilian takes am and den slot am into di far bottom corner.
56 mins: Martin Odegaard feed Ben White, but im cross dey blocked by Joel Matip.
57 mins: Alisson punch away Bukayo Saka corner but di Arsenal man dey fouled by Diogo Jota so dem get free-kick on di right wing.
Alisson punch out Martin Odegaard free-kick.
58 mins: Martin Odegaard dey down injured and Arsenal play on but Gabriel Jesus come trip over im team mate. E fall down.
Di medics run enta pitch.
60 mins: Jesus don stand up again as play continue.
62 mins: Granit Xhaka fire shot to di box but e go over di bar.
65 mins: Bukayo Saka hook di ball across goal from a tight angle but Konstantinos Tsimikas acrobatically clear am off di line before Martin Odegaard get free header into empty net.
69 mins: SUBSTITUTION
Ibrahima Konate come on for Liverpool for Joel Matip.
And Fabinho come on for Mohamed Salah.
70 mins: Fabinho foul Ben White with im first action. Na free-kick.
72 mins: Gabriel Martinelli get di ball around di box and pass am to Granit Xhaka, but Ibrahima Konate block im ball.
73 mins: PENALTY!
Na penalty to Arsenal.
Thiago catch Gabriel Jesus. E happun moments afta Alisson make a double save.
Bukayo Saka go take am.
76 mins: GOAL!
Arsenal 3-2 Liverpool
Saka score di penalty.
79 mins: Aaron Ramsdale try to catch Darwin Nunez cross but e iss di ball entirely, but nobody dey behind am to score inside di empty net.
81 mins: SUBSTITUTION
Harvey Elliott den on for Diogo Jota for Liverpool.
82 mins: Arsenal make change. Defender Kieran Tierney replace captain/midfielder Martin Odegaard.
88 mins: Harvey Elliott go down inside di box. No penalty.
90 mins: Injury time. Dem don add five minutes.
90 +1: mins: Gabriel Jesus dey replaced by Eddie Nketiah. Dis na afta e dey knocked down again inside di box afta e jam Allison.
90 + 3 mins: Dem award corner to Arsenal but e no do anytin.
90 + 4 mins: Arsenal Fabio Vieira replace Bukayo Saka.
90 + 5 mins : Ben White kicks for touch basically and boots the ball out for a Liverpool throw-in near their own corner flag.
We're going to have extra extra time added on for sure.
90 + 7 mins: Ibrajim Konate commit foul.
90 + 8 mins: Jordan Henderson shot and Harvey Elliott shots dey blocked.
FULL-TIME
Arsenal 3-2 Liverpool
Arsenal top di Premier League table
Team news - Zinchenko & Fabinho both dey out
Mikel Arteta dey forced into making one change to di Arsenal team wey beat Tottenham 3-1 for last Saturday north London derby.
Oleksandr Zinchenko don drop out of di matchday 18 entirely, with Japan Takehiro Tomiyasu coming in for left-back.
Arsenal: Ramsdale, White, Saliba, Gabriel, Tomiyasu, Partey, Saka, Odegaard, Xhaka, Martinelli, Jesus.
Subs: Turner, Tierney, Nketiah, Holding, Soares, Vieira, Sambi Lokonga, Nelson, Marquinhos.

Liverpool make three changes from dia 3-3 draw at home to Brighton last Saturday.
Luis Diaz, Diogo Jota and Darwin Nunez all come into di side, with Fabinho, Roberto Firmino and Fabio Carvalho drop out.
E mean Jurgen Klopp side dey likely to move away from dia traditional 4-3-3, with a 4-2-3-1 looking likely.
Liverpool: Alisson, Alexander-Arnold, Matip, Van Dijk, Tsimikas, Henderson, Thiago, Salah, Jota, Diaz, Nunez.
Subs: Kelleher, Gomez, Fabinh, Konate, Milner, Firmino, Elliott, Carvalho, Phillips.











