Kobe Bryant: See how fans and celebs honour LA Lakers basketball legend

LeBron James and Quinn Cook

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, LeBron James (centre) dey look up as im team-mate Quinn Cook dey wipes tears from im face
Read am in 2 mins

LeBron James na im lead di tributes for LA Lakers legend Kobe Bryant for di team first game since him and im daughter Gianna plus seven oda die for helicopter crash.

Di Lakers lose 127-119 to Portland Trail Blazers for Staples Center for night wey di team bin dey remember Bryant 20-year career for LA, wia im deliver five NBA championships.

Lakers players wear shirts with Bryant numbers - eight and 24 for dia back during dia warm-up and dem print 'KB' logo for di court.

Dem begin di tribute by introducing Lakers' line-up as "number eight, Kobe Bryant", before R&B artist Usher sing Amazing Grace in front of yellow rose arrangements in the shape of Bryant jersey numbers.

Dem place Kobe number 24 and Gianna number two jerseys for di seat wia dem watch dia last Lakers game.

"Dis na celebration of 20 years of sweat, tears, di broken down body, di getting up," na wetin Lakers forward James tok.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

"To sitdon hia to do everything plenty-plenty hours, di determination to dey great as like e be

"Tonight we dey celebrate di pikin wey come here 18 years of age, come retire at 38 and become di best papa wey we don see over di last three years."

Bryant, bin retire for 2016, im bin dey travel to go im 13-year-old daughter basketball practice when di accident happen for Calabasas, California on 26 January.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Blazers forward Carmelo Anthony, wey be Bryant paddy man no play for Friday' game as im "no dey ready", according to his team-mate Damian Lillard.

NBA players go wear uniforms as tribute to Bryant for February All-Star weekend, Team James go wear number two, Gianna basketball jersey number, and Team Giannis (Antetokounmpo) go wear Kobe number 24.

Di jersey dem go also feature nine stars, wey go represent those wey die for di crash.

LeBron James

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, LeBron James wears shoes as tribute to Kobe Bryant for LA Lakers' first game since im death
LA metro

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, One LA metro pay dia own tribute to Kobe Bryant, before di game on Friday
Lebron James

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, LeBron James addresse di Staples Center crowd before di Lakers' game against Portland
Tribute for di nine pipo wey die for di crash

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Tribute for di nine pipo wey die for di crash
LeBron James tattoo

Wia dis foto come from, LeBron James/Instagram

Wetin we call dis foto, LeBron James post image of im tattoo tribute to Kobe Bryant