Premier League: VAR, Man City, Liverpool, Arsenal and oda tins we learn from di opening weekend

Wia dis foto come from, Reuters
Afta months without di gbigbigbi wey club football dey cause for chest, fans gada around dia television again last weekend as di English Premier League return.
New coaches, new players, new hairstyles and new jersey full ground, but las las, na di football pipo go tok about. Here na four tins wey we learn.
E go hard to stop Manchester City

Wia dis foto come from, Michael Regan
Wen Pep Guardiola bin dey show teams pepper for Spain and Germany, di kwesion many pipo bin dey ask na weda im fit do am for English Premier League. But afta im Manchester City win am wit records last season, di kwesion now na who fit stop dem dis season. Di team don play Chelsea for Community Shield and Arsenal for dia first game of di season and for di two games, dem no too sweat to win.
Liverpool look like ogbonge team

Wia dis foto come from, Reuters
Anybodi wey watch Liverpool last season go sabi say dem be team wey score goals wella. Dia front players wey be Mo Salah, Sadio Mane and Roberto Firmino put fear for many defenders bodi. But di area wey e bin look like say dem get wahala na for defence and goalkeeper. Now, dem don sign Brazil number one goalie Alisson Becker plus defender Virgil van Dyke wey bin join dem for January. If you add Naby Keita and how im use play against West Ham on Sunday, den dis Liverpool team fit challenge for di trophy.
E be like noting don change for Arsenal

Wia dis foto come from, Reuters
Most pipo bin dey expect to see sometin different from Arsenal new coach Unai Emery and im boys, but di way dem take play against Manchester City make many pipo wonda. Okay, dem try to dey pas di ball from back, wey make dem make plenti mistake, but di fight pipo bin dey expect to see no dey for di team. Many players still play like say dem dey preseason and Emery need to start to work im magic fast, as dia next game na against Chelsea.
EPL need VAR and fast too

Wia dis foto come from, ANDY RAIN
Afta how e perform for World Cup, most fans go prefer to watch dia football wit Video Assistant Referee aka VAR. Anybodi wey see Liverpool third goal wey Sadio Mane score against West Ham go wonda how di linesman take miss offside wey wide like compound. For di first game of di season between Newcastle and Tottenham, na goal line technology give Spurs dia first goal, and e go make sense to see VAR too.
Table from opening weekend










