Arsenal vs Man City: Unai Emery market no sell Gunners on Premier League opening day

Wia dis foto come from, AFP
Unai Emery first Premier League match as Gunners coach end inside defeat on Sunday as Manchester City beat Arsenal 2 - 0.
Raheem Sterling score di first goal for 14 minute wit powerful strike from edge of box and Bernado Silva sama di second goal for 64 minute wit left-leg e take shoot ball.

Mesut Ozil for score for Arsenal, but na from an offside position so di refree cancel am.
Cech also make excellent save from Aguero and Mahrez.
Manchester City coach Pep Guardiola say im side go do even betta pass wetin dem do Arsenal for dia opening day for di Premier League season.
Sunday Premier League Football Scores
Earlier, Liverpool beat craze comot West Ham head 4 - 0 show and Southhampton jam Burnley 0 - 0.








