Australian Open: Caroline Wozniacki beat Simona Halep to win first Grand Slam title

Caroline Wozniacki spread am as she win match

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Caroline Wozniacki go climb back to world number one on Monday
Read am in 1 mins

Denmark Tennis player Caroline Wozniacki don beat Romanian Simona Halep to win her first Grand Slam title for Australian Open.

Di second Wozniacki seed win 7-6 (7-2) 3-6 6-4 for tough conditions to finally land major trophy after she don try 42 times.

"I don dream of dis moment for so many years, and to dey here today dat dream don come true," talk Wozniacki.

Dis victory mean say di 27-year-old go replace Halep as number one for di world rankings on Monday.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Two times before, Wozniacki don come second for US Open. She be di first Denmark player to win Grand Slam singles title.

Halep, too dey hope to win first major title but she don lose for Australian Open final and two French Open competitions.

"Of course I dey sad but Caroline play pass me," Halep bin talk.