Ghana striker, Raphael Dwamena go soon join Brighton

Wia dis foto come from, EPA
Brighton and Hove Albion don conclude plan to sign Ghanaian international player, Raphael Dwamena.
Di 21-year old bin dey play for FC Zurich and na "undisclosed" amount di two teams dey do for dis transfer matter.
Brighton first use £8m bid for Dwamena, but reports bin say FC Zurich want £13.7m ($17.5m).
Brighton nickname na "Seagulls" and dem just dey join Premier League. Di two games wey dem don play dem never score any goal.
Who be dis Dwamena?
Di new player dey come from Swiss League where im don score 33 goals, still do 11 assists for di 2016/17 season.
BBC tori person, Oluwashina Okeleji say Dwamena no be big player like that, but from di way wey im dey play, na promising and upcoming player.
Mr Okeleji say as Brighton and Hove Albion don sign di guy, e mean say dem don scout am well-well; Dwamena sef fit help dia team as dem hope to go far for English Premier League.
5 things you need sabi for Brighton and Hove Albion
- Dem open di club for 24 June 1901 at Seven Stars public house in Ship Street, Brighton.
- Dia nickname na Seagulls
- E don tey wey Brighton dey for Premier League, na since 1983 dem dey part of top league
- Dem don sell dia stadium before to pay money dem borrow
- Dem be di only professional team for Sussex from 1920 to 2011 until Crawley Town get promotion to Football League

Wia dis foto come from, Getty Images
Who Brighton don buy?
As transfer window open for July 1, Brighton don try to arrange players wey go fit help dia team as dem dey join Premier League.
End of Di one wey oda users dey read well well
One major thing be say, di money wey dem use for many of dia signings dey undisclosed. Na im be say nobodi too sure how much dem don spend for dis transfer season.
So far, dis na di transfers wey don happen for Brighton and Hove Albion:
In
Jose Izquierdo (Club Brugge) £13.5 m
Pascal Gross (Ingolstadt) Undisclosed
Josh Kerr (Celtic) Undisclosed
Mathew Ryan (Valencia) Undisclosed
Markus Suttner (Ingolstadt) Undisclosed
Mathias Normann (FK Bodo/Glimt) Undisclosed
Izzy Brown (Chelsea) Loan
Steven Alzate (Leyton Orient) Undisclosed
Ales Mateju (Viktoria Plzen) Undisclosed
Davy Propper (PSV Eindhoven) Undisclosed
Soufyan Ahannach (Almere City) Undisclosed

Wia dis foto come from, Getty Images
Out
Elvis Manu (Genclerbirligi SK) Free
Jordan Maguire-Drew (Lincoln City) Loan
Christian Walton (Wigan) Loan
Rob Hunt (Oldham Athletic) Undisclosed
Oliver Norwood (Fulham) Loan
Ben White (Newport County) Loan
Tom Dallison (Accrington Stanley) Loan
Tyler Forbes (Accrington Stanley) Loan
Kazenga LuaLua (QPR) Loan
Archie Davies (Whitehawk) Loan
Mathias Normann (Molde) Loan Details










