Omotomi Akinsanya Victoria Island: Police arrest Lebanese for Lagos accident outrage

Wia dis foto come from, BBC/AYO BELLO
Police don arrest one foreign driver wey allegedly hit one female for Victoria Island, Lagos, Nigeria.
Nigerians hala wit outrage begin seek for justice afta one Lebanese man, wey police don identify, allegedly knock down a lady around Sanusi Fafunwa Street.
Lagos State Police Command PRO tell BBC Pidgin say di driver John Greg bin dey drive recklessly.
Police identify Victoria Island accident victim
SP Benjamin Hundeyin say Greg allegedly move against traffic on Sanusi Fafunwa Road thereby hitting one female Omotomi Akinsanya.
"Dem conduct successful operation [surgery] for di victim [Omotomi Akinsanya] leg on Thursday morning for wia she dey undergo treatment". Hundeyin tok.
Police say dem don transfer di Lebanese man from di local police station wia dem first arrest am for Victoria Island, Lagos.
"Di man [John Greg], dem don transfer am go State Criminal Investigative department [wey dey Panti division inside Yaba] for further investigation.

Wia dis foto come from, SP Benjamin Hundeyin/Twitter
Victoria Island, wey be central business district for Nigeria commercial capital dey trend on Twitter sake of wetin happun to Omotomi Akinsanya.
End of Di one wey oda users dey read well well
Police add say dem no just arrest Greg, dem also impound im car.
Di victim, Omotomi Akinsanya dey collect treatment for di Lagos State University Teaching Hospital (LSUTH), according to police.
Police don inform di Embassy of Lebanon about di incident and dem don also begin investigation, Hundeyin tok.
Di police tok tok pesin say dem don carry Greg go do alcohol test and dem go present di result of di test to court.
According to Nigerian laws, a suspect dey innocent, until proven guilty.

Wia dis foto come from, BBC/AYO BELLO
Lagos traffic accident palava
Twitter users wey don comment on dis mata dey wonder wetin go make di driver reportedly drive against traffic.
However Lagos na city of over 22 million pipo and traffic na daily palava for pipo inside di commercial capital of Nigeria.
Notorious traffic jams dey di Nigerian city of Lagos but driving against traffic na offence.
Just recently, some pipo for Lagos bin dey complain of experience of how traffic robbers attack dem.
Sake of dis, some Lagosians enta social media to call on di attention of di state governor and police to address di situation.
Na millions of vehicles dey Lagos and accidents na one social issue wey dey regular for di very populated city wey dey south west Nigeria.













