Richard Gbadebo: How University of Ibadan 300 level student take die for soap factory

Wia dis foto come from, Twitter
Friend of Richard Gbadebo, di student of University of Ibadan wey die for one soap company for Ibadan, don tok about di kain person wey im be.
Di friend, Chinomso Okore, say na her only friend and dey always remember to call every time.
"Where I go fit start from? Richard na very nice and cool person. He also dey very social. Im be my only friend wey dey always call me," na wetin Chinomso tell BBC Pidgin.
According to local tori, Gbadebo die on Monday after im fall inside soap-making machine for Henkel Nigeria Limited factory wey dey produce WAW soap.
Richard, wey dey 300 level for department of European studies, bin dey work for di factory as schools still dey lockdown sake of coronavirus.
Sewa Gbadebo wey bin im senior sister tok say dem never bury am as dem still dey wait make police release im bodi to dem.
Di Oyo State Police Command don tok say dem dey carry out autopsy for di dead bodi of Richard, say na why dem never release di bodi to di family be dat.
"Police go need do investigation to wetin truly cause di death of di boy. Wen we finish, we go give di commissioner wetin we find and also give am recommendation on top di matter.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Na di normal protocol say to do autopsy before we go carry di body give di family," na wetin police tok tok person, Olugbenga Fadeyi, tell BBC Pidgin.
Also, di special assistant to Oyo state goment on student affairs, Victor Olojede, don ask make di soap company release CCTV of wetin hapun di day wey Richard die.
Di company, Henkel Nigeria Limited, don say sorry to di family of Richard and promise say dem go investigate di matter.












