George Floyd case: 'George Floyd' law dey consider to punish US police officers wey tanda, no stop bad tin

Wia dis foto come from, AFP
Di US city of California dey consider to conclude ontop one new tough law afta di death of George Floyd wey go punish police officers wey see bad tin but tanda dey look.
Dis dey come afta lawmakers, like many odas, bin feel say di police officers wey see dia colleague Derek Chauvin bin kneel down for oga Floyd neck and no do anything to stop am, get case to ansa.
In fact dem feel say law suppose dey wey go make sure say di kain tin wey officers go tanda dey look as pesin dey die for dia front, no happun again - since di law go force police officers to stop dia fellow colleague wey dey do wrong tin.
In di case of oga Floyd death on 25 May, officer Chauvin kneel on top im throat for 8 minutes 46 seconds as oda officers around just dey look and many pipo say di so-called "blue code of silence" na part of di blame.
Blue code of silence na di way police officers for America dey protect each oda. When one of dem do wrong, oda police officers must keep silent about am or pretend say dem no see anything.
Di bill AB-1022 say e go make any "peace officer wey dey present and see anoda peace officer dey use too much force, and e no stop am as per wetin dia law enforcement agency tell dem to do, even though say e get di ability to stop am, then e go follow carry criminal offence wey di officer commit in di use of excessive force".
Wetin e mean be say di bill wey California lawmakers don begin torchlight since February 2019, go make am crime for any officer inside di state to do blue code of silence.
Wetin di 'George Floyd' California AB 1022 bill go do
- Prevent retaliation against law enforcement officers wey report violations of law or regulation of anoda officer to a supervisor
- Make di officer wey no stop anoda officer wey dey use too much force, to face di same punishment as di offending officer
- Create website wey get record of officers including name, so as to allow members of di public to file citizen complain
- Make any officer wey dey present and see anoda peace officer dey use excessive force, and e no stop am, to follow carry criminal offence wey di officer commit in di use of excessive force
But di bill wey Assemblyman Chris Holden carry come dey face serious opposition as law enforcement agencies around di state dey para to block am.
End of Di one wey oda users dey read well well
Those against am say for many police situations, tins dey happun too fast sotey time no dey dey for oda officers to try stop am.
Di tok "I no fit breathe" wey George Floyd mention many times before im die don become popular worldwide as protest slogan against police brutality for di United States and against police no dey face prosecution for dia actions.















