Iran President apologize to neighbouring kontris as Dubai Airport suspend flight operations

Iranian president pointing hand, wit Iran flag by di side

Wia dis foto come from, IRANIAN PRESIDENCY / HANDOUT via Getty Images

Read am in 4 mins

Di President of Iran Masoud Pezeshkian don apologise to dia neighbours say dem no get intention to attack dem.

President Pezeshkian declare for im broadcast video message for Iranian state television say Iran go stop dia attacks, unless any kontri attack dem first.

Di Iranian President call for regional cooperation to "establish peace and calm" and dem no "intend to invade neighbouring kontris."

"I see am necessary to apologise to neighbouring kontris wey dey chop attack," e tok.

E say Iran go kontinu to dey resist, but di leadership don also cut warning give di armed forces say make dem no attack neighbouring kontris.

"From now on, no attack neighbouring kontris unless dem attack first."

"Dos wey dey consider to use dis moment to attack Iran no suppose become puppets of imperialism."

Dis na part of di latest on top di conflict wey dey go on behind di US-Isreal and Iran.

Meanwhile, di BBC don verify footage wey show drone striking near Dubai International airport.

Video wey don spread on social media show explosion and thick smoke above close to di terminal.

For di footage, we hear one man dey describe "anoda drone" and whirring sound dey loud just bifor di explosion.

Di exact location of di impact neva dey clear, but e appear say na near di airport concourse A.

Dubai suspend flight operations

Dubai International Airport don suspend all operations, sake of di ongoing attacks wey dey affect major infrastructures for di Middle East.

Dem say di flight suspension na "di safety of passengers, airport staff, and airline crew".

For di statement wey di Emirates use announce di flights suspension to and from Dubai, dem say na till further notice.

"Please do not go to the airport," Dubai airport say.

Di airline say dem go give update wen dem dey available say di 'safety of dia passengers and our crew na di highest priority.'

Meanwhile, di Emirates later release anoda statement say dem go resume operations, but updates neva dey if flights don resume.

Also, confusion about status of flights in and out of Dubai dey as di missile strikes neva stop.

Di United Arab Emirates say dem intercept anoda Iranian strike dis morning.

On X, di official account of di Govment of Dubai Media Office call am "minor" incident wit some falling debris but no injuries dey.

Iran say dem strike oil tanker for di Gulf

Di Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) say dem target an oil tanker for di gulf wey dey pass through di Strait of Hormuz.

For dia statement for Telegram, Iran say an oil tanker under di name "Prima" chop strike by drone afta e "ignore repeated warnings" issued by di IRGC Navy about di "prohibition of traffic" through di strait.

Di IRGC add say dem no dey allow oil tankers and commercial vessels wey dey in "ally wit hostile countries" to pass through di Strait.

Di Strait of Hormuz na of di world most significant lanes for shipping energy, and about fifth of di world oil and gas passes through am.

Di war for Middle East don see shipping lane stop to standstill, wit di Iranian regime threatening earlier dis week say dem go "set fire" to vessels wey attempt to go through.

US President Donald Trump later say dat di US navy fit escort ships through di passage "if necessary".