Organ-harvesting meaning, victims and risk
![What is Organ-Harvesting?: Organ-harvesting meaning [Ike Ekweremadu, Nwanneka arrested for ‘organ-harvesting plan’: UK Court remand Nigerian Senator, wife]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/e5b1/live/1c46f2f0-f314-11ec-bd41-87b161902afa.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Getty Images
Meaning of Organ harvesting don pick di interest of many Nigerians.
Two prominent Nigerians chop arrest on suspicion of plotting to harvest di organs of one pesin for UK.
So wetin be organ-harvesting? Dis tori go explain di full meaning.
Organ harvesting essentially na ‘killing on demand’, dis na di selling and transplanting of organs of victims.
Dis definition na wetin international society for human right tok.
Dem say organ harvesting dey take place for various kontries for di world, especially in China, India, and on the Sinai Peninsula.
Organ harvesting simply mean di surgical procedure wey go illegally remove organs or tissues for reuse, mainly for organ transplantation.
Sometimes e dey happun against di will of di organ owner.
End of Di one wey oda users dey read well well
E also mean di removal, preservation and use of human organs and tissue from di bodies of di recently dead pesin to be used in surgical transplants on di living.
Victims of Organ Harvesting
Some pipo dey voluntarily sell dia organs to traffickers on di black market in exchange for money, according to one Delta-net international journal.
E be lucrative business and kidneys, for example, na wetin dem dey buy for an average of $150,000.
In theory, healthy individuals with two fully functioning kidneys fit continue to live healthily when one dey removed, however dis no be always di case.
Some victims dey see dia organs forcefully removed. For example:
- Victims fit dey kidnapped and see one organ forcefully removed.
- Some victims dem dey trick dem into believing say dem require surgery alias operation and whilst under anaesthetic dem go remove one organ without dia knowledge or consent.
- Sake of di movement of political refugees wey dey go in Europe, plenty individuals don dey offered assurance of safe passage to Europe in return for one organ.
- Many victims of forced organ harvesting fit don previously be human trafficked, anoda form of modern slavery.
- Oda victims dey killed on demand and get dia organs removed to fulfil an order.
![What is Organ-Harvesting?: Organ-harvesting meaning [Ike Ekweremadu, Nwanneka arrested for ‘organ-harvesting plan’: UK Court remand Nigerian Senator, wife]](https://ichef.bbci.co.uk/ace/ws/640/cpsprodpb/c144/live/98eef760-f325-11ec-bd41-87b161902afa.jpg.webp)
Wia dis foto come from, Getty Images
Risks of Organ Harvesting
Organ harvesting dey very risky because na major surgery dem dey do.
For example, risks of kidney donation from a living donor include:
- Severe pain
- Blood clots
- Incisional herniation
- Serious infection
- Adverse drug reactions
- Pneumonia
- Lung collapse
- Psychological symptoms
- Death
Even wit di standard risks of major surgery, based on say dis na illegal parole tins dem fit no consider tins like hygiene.
Dis go increase di risk of infection and endangers victims.
Places where organ-harvesting dey high
Organ harvesting or evidence of organ harvesting dey for various kontries for di world.
Especially for places like China, India, and di Sinai Peninsula.
Na so international society for human rights tok.
People’s Republic of China
Organ transplantation for People’s Republic of China dey boom well-well, for dia di number of transplants dey rise.
Evidence suggest say dem murder pipo to sell and transplant dia organs –wit allege involvement and support of goment agencies.
Most cases of organ harvesting in di world dey take place for China.
Sinai Peninsula
Egypt na di regional hub of organ trafficking. According to World Health Organization.
For 2010, smuggling networks carry at least 14,000 refugees pass di border into Israel.
On dia way through Egypt, organized criminals block di refugees and migrants, dem dey only release dem afta dem pay ransom.
According to UN Refugee Agency, if family members of di refugees no pay ransom, dem go sell dem to gangs for northern Sinai, most times di gang dem dey kill dem and comot dia organs.
In 2017 di National Agency for di Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP) say dem go begin look into illegal human organ harvesting in Nigeria.
For late 2021 report say Director-General of NAPTIP Basheer Garba Muhammed say a ‘farm’ don dey identified inside Libya where dem dey allegedly keep Black African migrants in cages like animals.
Di NAPTIP oga reveal say dia vital organs such as eyes, kidneys and lungs go thereafter dey harvested and di hervesters go sell am for black market to service di medical needs of Europe. ICIR quote di Nigerian official.
Organ Harvesting dey legal?
For now na only one kontri in which e dey legal to buy and sell kidneys: Iran. Delta-net international journal don find out.
But for oda places you fit selflessly donate some of your organs (including kidneys) but not for monetary gain.
Pipo dey most times donate kidneys to dia loved ones and family.
But e also legal to donate your organs to strangers as an act of compassion.
For dis no exchange of money dey involved and make e no dey confused wit forced organ harvesting.











