Boakai still dey lead against president George Weah for Liberia presidential runoff results

Latest election results from di Liberia run-off elections dey show say opposition candidate Joseph Boakai still dey in di lead wit 50.89% now wey dem don count 99.58% of votes.
Dis announcement bin come on Friday following Liberia run-off elections.
So far di 78 year old dey beat incubent president George Weah wey now come get 49.11% of di votes
As at now Boakai get 712, 741 votes wey im don get for di results from di runoff of di polls.
While di incumbent president George Weah dey tanda wit 696,520 votes wey be 49.42% of votes.
Di chair pesin of di commission, Davidetta Browne Lansanah bin announce say dem go need do rerun of di elections for 25 polling units before dem go fit announce di final results.
She also reveal give tori pipo say di kontri spend 53 million Liberian dollars to conduct both di main election and di runoff.
Neither President Weah nor Boakai bin achieve more dan 50% of di vote for di first round of di election, and na im trigger di run-off.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di same two candidates bin also face each oda for di 2017 election, wey end for run-off, and President Weah win di election dat year.
Di final run-off results dey expected to dey released within 15 days from di 14 November polling date.
Liberia still dey struggle wit di long-term impact of civil wars and di economic impact of Ebola outbreak plus di Covid-19 pandemic.

Wia dis foto come from, AFP/Reuters
Vote counting bin start for Liberia on 14 November afta di polls close for 6:00 pm local time, di kontri election commission chairpesin Davidetta Browne Lansanah tell tori pipo.
Di election join-bodi chairpesin add say even though di election bin waka smoothly, dem quickly handle one fake tori for social media say pipo discover fake ballot paper.
Di voting wey bin last for 10 hours na run-off election afta one tight race between di sitting President John Weah and im opponent Joseph Boakai for effort to reach 50% vote wey dem need to become winner.
Di tally of vote begin on Wednesday for di Helen Johnson Sirleaf ministerial complex.
Di presidential run-off election shelle afta di two leading candidates bin get just 7,000 plus votes for di first round wey happun one month ago.
Dem go choose between di current president wey be one-time football star, George Weah, and former Vice-President Joseph Boakai.
Di president bin narrowly win di first round but fail to get more dan 50% of di vote, wey make dem go di run-off.
Di first round of election wey bin happun for October bin get plenty allegation of fraud and violence.
Di kontri election commission say nine of im temporary staff bin chop arrest over alleged ballot-tampering.
UN bin also report clashes between supporters of rival opposition parties.
Dis na di number four presidential election since di end of di kontri two civil wars wey bin last more dan 20 years, and kill 250,000 pipo.

Wia dis foto come from, Moses Kollie Garzeawu
Weah, 57, wey get 43.8% of di vote for first round, and Boakai, 78, wey get 43.4%, bin try to build political collabo wit 18 oda candidates wey run for di first round.
Nobody inside dis 18 oda candidates bin get more dan 3% of di vote.
Boakai wey bin serve as vice-president to Ellen Johnson Sirleaf, Africa first elected female head of state, bin get di support of three out of di four best performing candidates, according to Reuters news agency.
Im focus on investing in agriculture and infrastructure for im election campaigns.
Weah on im part don dey tok about improving education and dealing wit unemployment.
Dis na di second time wey di two men dey face dem sef for presidential election run-off vote.
For 2017, Weah win Boakai wit 61% of di vote for di second round.
Dat time, im popular among di youth as international star and voters bin also dey attracted to im promise to fight corruption, sabi pipo tok.
Tuesday second round na a repeat of di run-off election for 2017. Den, George Weah defeat Mr Boakai. E win 61% of di vote.
According to Liberia constitution, di winner of di run-off only need a simple majority to win.
Dem go swear in di winner into office for January next year.













