KLM cancel flights to Dubai till 28 March as US-Israel war wit Iran continue - Wetin oda airlines tok

British Airways airline

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 5 mins

Thousands of flights to and from di Middle East still dey face serious disruption since late February, following Iranian strikes across di region in retaliation to US and Israeli bombardment.

Di conflict for di region don force many airlines wey dey operate for di region like Dubai, Abu Dhabi, Doha to either suspend or cancel dia services, wey don leave many travellers stranded.

Di Dutch airline KLM na di latest airline to cancel all flights to Dubai until 28 March sake of di "ongoing geopolitical unrest for di Middle East", dem tok.

Earlier, officials for Dubai tok say two drones "bin fall for di vicinity" of Dubai International Airport dis morning, and four pipo injure.

KLM

Di Dutch airline KLM don cancel all flights to Dubai until 28 March due to "di ongoing geopolitical unrest for di Middle East", dem tok.

"KLM remain available for di repatriation of stranded travellers," di airline tok for one statement on dia website and add say na di Dutch Ministry of Foreign Affairs dey coordinate am.

Below na di latest on which airlines don cancel or suspend flights to di region.

British Airways

On Tuesday, British Airways announce say sake of di continuing uncertainty of di situation for di Middle East, dem dey temporarily reduce dia flying schedule for di region.

For one statement on dia official X account, British Airways add say dem dey pause dia repatriation flights to UK from Oman sake of "reduced demand", and dem dey cancel more flights across di Middle East.

"We don cancel all flights to and from Amman, Bahrain, Doha, Dubai and Tel Aviv until later dis month and to and from Abu Dhabi until later dis year."

We dey keep di situation under constant review and we dey in touch wit our customers to offer dem a range of options, British Airways add.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Etihad

On Friday, Etihad announce say dem go begin operate limited flights from Abu Dhabi to last through dis week, following "extensive safety and security assessments".

Dem include scheduled services to London Heathrow and Manchester for UK.

Emirates

Emirates also say dem dey operate a reduced flight schedule.

Flights to Manchester, Birmingham, London Heathrow, London Gatwick, London Stansted, Edinburgh and Newcastle dey scheduled for dis week and available to book, according to dia website.

Emirates on Friday tok say dem go dey operate 11 daily flights across five airports, subject to ongoing airspace approvals.

But for one post on X, di carrier say dem dey expect a fast return to normality, "Di airline anticipate a return to 100% of dia network within di coming days, subject to airspace availability and difulfilment of all operational requirements."

Aegean Airlines

Greece largest carrier don cancel flights to and from Tel Aviv , Beirut and Baghdad until 29 March.

Dem cancel flights to Dubai and Abu Dhabi until di scheduled evening arrivals on Saturday, 28 March. Flights to and from Riyadh dey cancelled until Saturday, 14 March.

airBaltic

Latvia airBaltic don cancel all flights to and from Tel Aviv until March 28. Di airline add say dem don cancel all flights to and from Dubai until March 16, plus one Dubai-Riga flight on 17 March.

Air Canada

Di Canadian carrier say dem don cancel all flights to Tel Aviv until May 2 and all flights to Dubai until 28 March.

Air Europa

Di Spanish airline don cancel all flights to Tel Aviv until March 20.

Air France

Air France don suspend flights to and from Dubai and Riyadh until 14 and flights to and from Tel Aviv and Beirut to 15 March.

Qatar Airways

Qatar Airways don assure dia passengers say dem go resume operations once di Qatar Civil Aviation Authority confam di safe reopening of Qatari airspace.

Di airline bin temporarily suspend flight for di beginning of di conflict for di Middle East.

For one post on X, Qatar Airways say dem dey plan to operate selected flights in di coming days to support passengers wey di disruption affect.

"Dis flights no constitute confirmation of di resumption of scheduled commercial operations," di airline add.

Cathay Pacific

Di Hong Kong airline say dem don cancel all flights to and from Dubai and to and from Riyadh until 31 March.

Delta

Di US carrier don cancel flights from New York to Tel Aviv until 22 March and from Tel Aviv to New York until 23 March.

Finnair

Finnish carrier don cancel Doha and Dubai flights until 29 March, and dem dey avoid di airspace of Iraq, Iran, Syria and Israel.

IAG

IAG-owned British Airways don cancel flights to Tel Aviv, Amman, Abu Dhabi, Bahrain, Dubai and Doha until 12 March, wit a reduced schedule to Larnaca.

IAG low-cost airline, Iberia Express, don also cancel all flights to and from Tel Aviv until 10 March.

ITA Airways

ITA Airways don suspend flights to Tel Aviv until April and dem extend Dubai cancellations until 15 March.

Japan Airlines

Japan Airlines don suspend Tokyo-Doha flights scheduled from 28 February to 21 March and Doha-Tokyo flights until 22 March.

Lufthansa Group

German airline group, wey include Lufthansa, Austrian Airlines, Swiss and Brussels Airlines don suspend flights to Tel Aviv until 2 April and to Beirut until 28 March.

Di airline suspend flights to Tehran until 30 April and to Amman, Erbil, Dammam, Dubai and Abu Dhabi until 15 March.

Malaysia Airlines

Di Malaysian carrier don suspend all flights to and from Doha until 13 March.

Turkish Airlines

Turkish Airlines don remove Iran flights from dia programme until 12 March, di Turkish transport minister tok.

E add say dem don cancel all Turkish Airlines flights to Bahrain, Dammam and Riyadh (Saudi Arabia), Iran, Iraq, Jordan, Kuwait, Lebanon, Oman, Qatar, Syria and United Arab Emirates.

IndiGo

IndiGo say on 12 March, dia airline go operate flights to nine destinations across di Middle East, along wit select routes to Europe, subject to prevailing safety conditions and necessary regulatory approvals.

Dem say dem go continue to coordinate closely wit di relevant authorities to progressively restore dia flight operations across di Middle East.

Qatar Airline

Wia dis foto come from, Getty Images