UN Security Council go vote on US-Iran war as US target minesweepers near di Strait of Hormuz

Iran ambassador to the United Nations (UN), Amir Saeid Iravani

Wia dis foto come from, Spencer Platt/Getty Images

Read am in 4 mins

Di United Nations Security dey scheduled to vote on Wednesday for dia first resolutions since di start of di US-Israeli war for Iran.

Council members dey vote on top two drafts about di war and wetin e fit cause di region.

Di first draft wey na di Persian Gulf region kontris bin submit wey condemn di Iran attacks on dis kontris including Jordan.

But Russia wey be Iran paddy for di Security Council also carry dia own draft come. Dem no mention Iran, US or Israel but dem condemn attacks on civillians and ask make all sides of di war stop to dey fight and restart tok-tok again.

For di meeting, UN Secretary-General Antonio Guterres tok say Isreal and US airstrikes for Iran and Iran retaliation for di kontris for di region all go against di UN charter.

Meanwhile, Iran ambassador to di United Nations, Amir Saeed Iravani bin criticize di kontris of di Persian Gulf region - e accuse dem say dem dey try to blame who start di gbege and who be di victim wit wetin e call "biased and politically motivated" text.

Di draft for Iran to stop all dia attacks for di six Gulf kontris and Jordan don get ova 90 co-sponsors wey include Britain.

Dem also condemn any action or threat by Tehran wey fit lead to di closure or press pause on international shipping through di Strait of Hormuz.

As all dis one dey go on di US military release footage of exploding ships wey dem say na plenti Iran naval vessels wey US attacks fire down.

Dis dey happun as di US Central Command bin announce say di targets wey dem "eliminate" on Tuesday inclide 15 mine layer wey dey near di Strait of Hormuz.

US Chair of di Joint Chiefs of Staff Gen Dan Caine bin don tok for Pentagon briefing on Monday say to scata Iran navy na among di three main objectives of Operation Epic Fury.

US President Donald Trump bin threaten to destroy any Iranian vessels wey go attempt to mine di Hormuz Strait wey be key international shipping channel for di Middle East wia container ships don dey come under attack.

But one British naval agency wey dey monitor maritime security don report say one cargo ship bin dey targeted for di Strait of Hormuz.

According to dat joinbodi, di ship bin catch fire afta "projectile" hit and and dem don alreadi dey comot staff.

Di organization don report say anoda ship bin dey targetted for dat region bifor.

Wetin be Strait of Hormuz

Di Strait of Hormuz dey important for world pipo sake of say, around 20% of di world oil dey pass through dia, wit major oil and gas producers for di Middle East, wey dey use waterway to transport energy from di region.

US Energy Information Administration (EIA) estimate say for di first six months of 2023 around 20 million barrels of oil na im bin pass through di strait per day.

Dat one equal to nearly $600 billion worth of energy trade per year wey dem dey transport through maritime routes.

Any disturbance for di waterway fit cause significant delays to di delivery of oil to di world, wit immediate hike on prices.

However, analysts dey warn say e fit get even more serious consequence and dat na say e go make di conflict between Israel and Iran worse.

Strait of Hormuz na one length of water wey dey between Iran and Oman.

Im entrance and exit dey around 50km wide, and about 40km for im most narrow point for middle.

However, dis strait only dey deep enough for mighty ships if dem centre demsef for middle of di water.

Maritime navigation charts assign one safe lane for ships wey dey enta di strait, safe lane for di ones wey dey come out of am, and buffer zone between di two - all specifically for heavy oil tankers.

In total, very big ships must to navigate di channel wey dey only about 10km wide.

As tankers dey pass enta di Persian Gulf, dem dey near di islands of Greater and Lesser Tunb - dis na territories wey dey cause quarrel between Iran and Arab kontris.

Many sabi pipo dey reason am say di most likely method wey Iran go use disturb shipping for dat strait na through military action.

Na so e happun during di ran-Iraq war from 1980 to 1988.