All you need sabi as US warn of possible terrorist attack for Nigeria

Foto of militants wey carry gun and di president of US, Donald Trump.

Wia dis foto come from, Pius Utomi Ekpei/AFP/Getty Images

Read am in 4 mins

Di United States embassy for Nigeria don warn say possible terrorist threat wey dey target US facilities and US-affliated schools fit happun for Nigeria.

Inside one security alert wey di embassy issue on 9 March, di US mission for Nigeria advise American citizens make dem dey very vigilant wen dem wan visit dia diplomatic facilities and affiliated institutions

Di mission also ask American citizens make dem take extra precautions wen dem dey travel go U.S. diplomatic premises for Nigeria.

Di embassy advise citizens make dem dey aware of wetin dey happun around dem and make dem avoid any routine wey dey predictable.

Dem also urge nationals make dem review dia personal security plans wit family members.

"U.S. Embassy for Abuja don inform all Americans say possible terrorist threats against U.S. facilities and U.S affiliated schools for Nigeria," di advisory tok.

"Di Embassy dey recommend make U.S. citizens take extra precautions wen dem dey travel go U.S. Embassy, di U.S. Consulate General for Lagos, and U.S. affiliated schools, fit change time and route wey dem dey use."

"Increase di awareness of your surroundings, avoid predictable routines, and reviewing general security precautions wit your family fit help reduce your risk."

Among di safety measures wey dem list na make maintain low profile, stay alert for public places, and avoid crowd and protests.

Di embassy also advise dia citizens make dem make sure say dia mobile phones dey charged and make dem sabi di emergency exits wen dem enta any building.

Di mission tok say di consular sections for di embassy for Abuja and di consulate general for Lagos still dey open.

Di embassy dey urge US citizens make dem dey check dia official website for more updates on di situation.

Dem also encourage travellers make dem enrol for di Smart Traveler Enrollment Program (STEP) to get security updates.

Terrorist kill soldiers and residents for communities in Nigeria

For di past two decades, constant insecurity don dey drive pipo comot from dia homes, farms and dia ancestral land, terrorist don destroy many agricultural farm lands, barracks, houses and even displaced pipo for north-eastern states.

Recent attacks by Islamic State of West Africa Province (ISWAP) for Borno, attack some military bases across Kaga Local Govment Area, Kaga Local Govment Area and Gwoza Local Govment Area wia dem kill many soldiers for dia military bases.

Last week, ISWAP claim say na dem attack four military bases for one night, di incident wey dem tok say result to deaths of many sojas but di Nigeria Army deny di firgure from di local media.

Inside di statement last week, di Nigerian Army tok say dem don repel di attacks and defend di affected communities, but "sadly one commanding officer and some soldiers pay di supreme price while courageously confronting di attackers and prevent more devastation on oda communities."

On Monday, suspected terrorists attack two military bases for Goniri and Kukawa, Borno State, wia dem kill commanding officer and some soldiers, according to Premium Times.

Also, dem kidnap dozens of pipo for Ngoshe community for Borno wen dem attack di community last week.

Also, gunmen attack Woro and Nuku communities for Kwara state wia dem kill ova 75 pipo and burn down houses for di community for February.

Afta di attack, di Nigerian govement blame Boko Haram for di attack and describe di attack as "cowardly and beastly attack."

Schools shutdown ova security alert for Nigeria

For February, Kogi State govment temporary close down schools wey dey for di state to protect pupils, students, and teachers.

Afta dem get intelligence say terrorists wan attack some school, di state govment make dem close down di schools as protective measures rather make dem wait for avoidable incidents.

In November 2025, federal govment announce di closure of 47 Federal Unity Colleges across di kontri.

Dis order na afta two major abductions happun for Kebbi and Niger states in November.

Many schools for di northern region close down until December 2025 ova insecurity, including states such as Katsina, Kebbi, Yobe, Kwara, Niger, Taraba and Bauchi states.