Trump, world leaders react to Mojtaba appointment as supreme leader of Iran

Foto of Donald Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

United States President Donald Trump don tok say e "no dey happy" wit Iran appointment of Mojtaba Khamenei as dia new supreme leader, according to one programme on Fox News.

Anchor Brian Kilmeade tok say im don follow di US president tok. Afta di announcement, e tell me: "I no dey happy."

Kilmeade no provide further details of wetin im tok wit Trump and di president neva comment publicly.

On Sunday, Iran name Mojtaba Khamenei as im papa Ali Khamenei successor as di new supreme leader.

Di 58-year-old Mojtaba na mid-ranking cleric wit plenty influence inside Iran security forces and wide business networks under im papa.

Russia, China warn against interference

Russian President Vladimir Putin, on Monday, promise say Russia go stand gidigba wit Iran new supreme leader, Ayatollah Mojtaba Khamenei, wey dem appoint afta US and Israel strike kill im papa.

Putin yarn dis one inside one message wey im send to Khamenei "I go like to reaffirm our unwavering support for Tehran and solidarity wit our Iranian friends." E add say, "Russia don dey and e go still remain partner to Iran."

"At a time wey Iran dey confront armed aggression, your tenure for dis high position go undoubtedly require great courage and serious dedication," di Russian leader tok.

While Chinese foreign ministry tok say di election of Mojtaba Khamenei, as di third supreme leader for Iran na decision based on di kontri constitution, according to di local media for China, Xinhua.

Di minister tok-tok pesin, Guo Jiakun tok dis at di daily press briefing in response to di appointment of Mojbata as di highest leader for Iran.

"China dey oppose interference for oda kontri internal affairs under any pretext, and we go respect Iran sovereignty, security and territorial integrity," e tok.

Missile attacks continue for Gulf afta di appointment of Mojtaba

Iranian state broadcaster IRIB don post on dia Telegram channel say dem hear explosion for Bahrain and Kuwait.

IRIB bin tok say dem hear siren for Bahrain, but dem no give any further information.

Some reports tok say dem hear "several explosion" for Doha, Qatar capital on Monday, as Qatar defence ministry tok say e don intercept missile attack early mor-mor.

Bahrain report on Monday say dem get di highest number of pipo wey die for one attack wey happun for Gulf states since di war start.

Di Health Ministry tok say di drone attack injure 32 civilians, including four children, wey di youngest of dem dey two months old.

At least 10 pipo don die for Gulf so far, and most of dem na security pipo or worker. Qatar, Kuwait, United Arab Emirates and Saudi Arabia sef don report new attacks wey happun for night.

Riyadh say dem intercept and destroy two set of drones wey dey come towards one major oilfield. Bifor, drone attack don hit US embassy and di State Department don tell govment workers wey no too dey important to comot for di kontri.

Officials for Iran don warn say dem fit start to attack regional infrastructure if Israeli and US strike continue to bomb dia facilities.

While Israel tok say dem don start serious 'wide-scale' attack for Tehran, Isfahan, south Iran afta missile wey Iran launch kill one pesin for Israel.

"IDF just start big attack against Iranian terror regime infrastructure for Tehran, Isfahan, and south Iran," di military tok.