'Dis na warning' - Israel threaten to target Ayatollah ‌Ali Khamenei successor

Mojtaba Khamenei

Wia dis foto come from, Tasnim News Agency

Read am in 4 mins

Di clerical body wey go choose Iran next supreme leader don almost reach agreement, Reuters report.

Di new Supreme leader go succeed Ayatollah ‌Ali Khamenei wey die for US-Israel strikes.

Reuters quote di Mehr news agency – say di informate na from di Assembly of Experts member Ayatollah Mohammadmehdi Mirbaqeri on Sunday.

The Mehr news agency quoted am say dem still need to resolve "some obstacles".

On Saturday, one senior cleric for di Assembly of Experts bin say dia members go meet "within one day" to choose di leader.

Iranian media say di group bin get minor disagreement over weda dia final decision must follow physical meeting or instead make dem announce am without dia normal formality.

Ayatollah Mohsen Heidari Alekasir, anoda member ‌of ⁠di Assembly of Experts

Wia dis foto come from, Telegram via Mehr News Agency

Wetin we call dis foto, Cleric suggest dem don almost decide Khamenei replacement - Iranian media

Ayatollah Mohsen Heidari Alekasir, anoda member ‌of ⁠di Assembly of Experts, tok for video wey Nournews on Sunday say physical meeting by di assembly for a final vote no dey possible based on wetin dey happun.

E tok say dem don pick one candidate, based on di late supreme leader advice say "make di enemy hate" Iran top leader "instead of to hail am".

"Even di Great Satan (U.S.) don mention im name," Heidari Alekasir tok ⁠of di chosen successor, days afta U.S. President Donald Trump say Khamenei son, Mojtaba, na "unacceptable" choice for am.

Meanwhile, Israel military don issue warning to Iran say dem go kontinu to pursue evri successor of di kontri supreme leader, Ayatollah Ali Khamenei wey don die.

For post on X, di IDF's Farsi-language account say: "Iran Assembly of Experts, wey neva seat for for decades, go soon gather in di city of Qom.

"We wan tell you say di hand of di State of Israel go kontinu to pursue evri successor and evri pesin wey seek to appoint a successor.

"We warn all those wey intend to participate in di successor selection meeting say we no go hesitate to target you either. Dis na warning!"

Trump accuse Starmer say e wan 'join war afta dem don win'

US President Donald Trump don tell di UK say e no need dia aircraft carriers and accuse Prime Minister Sir Keir Starmer say e dey try "join di war afta we don already win", as di US and Israel kontinu to launch strikes on Iran.

For social media post, Trump say UK bin "dey give serious thought" to sending two aircraft carriers to di Middle East, before dem tok say di US no "need dem". Downing Street neva respond.

One of di UK two aircraft carriers already dey on advanced readiness, di Ministry of Defence (MoD) confam.

Trump comment come afta dem US bomber jets dey land for UK as di US start to use British bases for "specific defensive operations".

"Di United Kingdom, our once Great Ally, maybe di Greatest of dem all, don finally give serious thought to send two aircraft carriers to di Middle East," Trump write on Truth Social on Saturday. "Dat one dey OK, Prime Minister Starmer, we no need dem again - But we go remember.

"We no need pipo wey come join Wars wen we don already win!"

Wen e dey tok on Air Force One in response to kwesion about di use of UK bases in di war, Trump refer to im post on Truth Social, saying: "We no need dem," dey appear to reference di carriers.

E add: "No be di right time. E for make sense if to say we get dem two weeks ago."

Di UK govment don remain clear say dem no get interest to join di wider offensive campaign for di Middle East.

While Sir Keir neva respond directly to Trump, e earlier write in for di Sunday Mirror say "for moments like dis, di kontri need seriousness, no be political games".

"While opposition parties seek to undermine Britain on di world stage, my Labour govment dey focused on protecting British pipo at home and abroad," e add.