Ghana lodge protest for UN afta missile attack on peacekeeping base for Lebanon injure three soldiers

Di attack wunjure three soldiers

Wia dis foto come from, SCREENGRAB

Wetin we call dis foto, Di officers' mess don burn as troops struggle to contain di fire and to try and salvage wetin dem fit find
Read am in 4 mins

Ghana don formally file protest to di United Nations afta one missile attack on Friday wey scata dia peacekeeping base for Southern Lebanon.

Two missiles attack di Ghana battalion headquarters for di UN interim force (Unifil) for Lebanon as Israel Defence Forces (IDF) and Hezbollah continue dia kasala.

Two soldiers don dey critically injured wey anoda one dey traumatized afta di attack, according to di Ghana army statement wey tok-tok pesin Captain Veronica Arhin don sign.

Di missiles hit di officers' mess wey don burn completely.

Inside one viral video - some of di soldiers bin dey try to fight di fire wit extinguishers as odas try to save some of dia equipment and personal tins, di rest bin dey run to safety.

Di Ghana armed forces say di injured soldiers don dey receive treatment for di level one medical bunker - as plans dey underway to evacuate dem to di Unifil referral hospital.

Di military say di "Ghana troops currently dey safe for underground bunkers."

Foto show some Ghana soldiers for inside bunker

Wia dis foto come from, SCREENGRAB

Wetin we call dis foto, Di Ghana army say di injured soldiers dey receive treatment inside one bunker as dem dey wait to evacuate dem to di Unifil headquarters referral hospital

'Dem for investigate dis mata and punish pipo'

Di kontri through di Foreign Affairs ministry don protest di incident for di UN headquarters for New York, wey dem ask di parties wey dey involved for dis conflict for Unifil, to dey mindful of dia responsibilities about di safety of all peacekeepers for dia.

Foreign Affairs Minister Samuel Okudzeto Ablakwa don lodge formal protest.

Inside di complaint wey dem address to UN secretary general Antonio Guterres, di Ghana govment ask for "full-scale and immediate investigation into di mata."

"Ghana don strongly condemn dis attack wey we also bin dey ask say make dem find di pipo behind am to face accountability sake of dis attack be grave violation of international law."

Di kontri foreign ministry tok inside dia statement say di attack also don dey amount to war crime against UN peace keeping personnel.

About those soldiers wey don hurt, Ghana govment say di "UN gatz to take steps to ensure safety and security of personnel wey bin dey serve under di mission, wey dey risk dia life to make sacrifice to serve humanity."

While some security analysts say di Ghana troops suffer di attack "as a result of circumstance, no be say dem target to kill Ghana soldiers on peacekeeping duties", odas tin say dem plan am.

the government lodged a formal compliant to the UN secretary general Antonio Guterres

Wia dis foto come from, GHANA FOREIGN MINISTRY

Wetin we call dis foto, "Ghana dey strongly condemn dis attack wey we dey demand say those wey dey involved go face accountability sake of dis be violation of international law" - Ghana foreign ministry tok

Meanwhile, local media outlet JoyNews report say di Israeli ambassador to Ghana, Liberia and Sierra Leone oga Roey Gilad don tok say wetin happun be "tragic event."

"We don dey send our well wishes and speedy recovery to di three soldiers wey efforts dey underway to identify di source of di fire wey Israel Defense Forces (IDF) bin dey investigate."

On top dia social media page Israel Defense Force deny say dem don launch ground invasion into Lebanon.

Dem say wetin dem do be "operation wey be tactical step to create additional layer of security for di residents of Northern Israel."

Israel Defense Force also add say "we no dey try to expand di war by attacking hezbollah for Lebanon, na Hezbollah decide to join di war by launching missiles at Israeli civilians."

"Di IDF dey respond to those attacks to defend our civilians."