Who be Daniel Bwala and why e dey trend?

Daniel Bwala on cap wit books by im side

Wia dis foto come from, Daniel Bwala/X

Read am in 5 mins

For di last couple of days for social media, na di tori and comments ontop Daniel Bwala, one of Nigeria President spokesperson bin fill di space.

Bwala na di Special Adviser on Public Communications and Media, to President Bola Tinubu.

Daniel Bwala name don come for different places on top social media, in fact, articles and posts dey fly upandan ontop im matta. Wetin happun?

You go first wonder weda Bwala bin win one kain election wey make di tok plenti like dis, but na sake of one interview wey e do wit British-American journalist Mehdi Hassan.

Dat interview don make pipo dey wonder who im truly be and why di mention of im name plenti like dis.

Daniel Bwala no be small name to Nigeria media space and also di political environment sake of idi roles wey e don hold for past.

Bwala na lawyer and popular public affairs analyst wey dey veri vocal about any issue wey e dey tok on.

But bifor dat time, Bwala na di former tok-tok pesin of former Vice President Atiku Abubakar during di 2023 presidential campaign under di Peoples Democratic Party (PDP).

Im appointment by President Tinubu mark one of di political twist for Tinubu administration - for appointing im leading opponent tok tok pesin to join im administration.

Bwala na one of dose wey confidently criticise di Tinubu APC administration, bifor di 2023 presidential election, during di election and even shortly afta di election.

Bwala bin first dey support President Tinubu during di presidential primaries of di APC, but later withdraw im support becos of di controversial Muslim/Muslim ticket of APC.

Bwala dey wit di PDP all through di 2023 Presidential election, and even afta dem declare Tinubu as winner of di election- Atiku wey be major opponent bin challenge di election results.

Na for early 2024, Bwala come shock many pipo wen im decide to dump di PDP candidate Atiku to work wit president Tinubu.

Wen di picture of wia Tinubu invite Bwala go di villa for Abuja bin enta social media, e be like shock but bifor you know, dem don appoint Bwala as Special Adviser and some pipo feel say Oga Bwala get di capacity to hold dat position while some say e betray im former boss Atiku.

Why Daniel Bwala dey trend?

Daniel Bwala and Mehdi

Wia dis foto come from, Daniel Bwala/X

Recently, Daniel Bwala honour di invitation of journalist Mehdi Hassan to come discuss issues wey surround President Tinubu administration.

Howeva, di outcome of dat interview cause serious tok tok for social media, as pipo tok say Bwala no ansa di kwesions wey dem ask am well.

Some Nigerians say, Bwala no suppose go dat kain interview unprepared.

During di interview wit journalist Mehdi Hassan, Bwala dey confronted wit several kwesions wey concern some statement wey e don make for past bifor President Tinubu appoint am.

Some of di old statements dey pour accuse ontop Oga Tinubu, wey be Bwala oga now. But Bwala tok for di interview say na lie oo, na im tok dat kain tin.

Meanwhile, dis no be di first time wey Bwala go appear for interviews, but e be like say Nigerians bin want more from am and im delivery no too go well.

Daniel Bwala bin react to di different tok tok wey sup afta di interview wey e appear.

"Dem suppose inform me so I go fit prepare my response. But dat one dey okay, ethically, dat dey on dem not on me.

Na part of wetin Bwala tok for im statement be dat.

Bwala say wen di program contact am for di interview, e say dem tell am say dem wan challenge di current administration on security, di economy, and corruption.

Howeva, Bwala lament say wen dem dey tok for about six months dem no inform am say dem go challenge im past.

"Nowia for our almost six months of communication dem no mention say dem go challenge my past. If dat na dia plan, ethically and professionally, dem suppose inform me so I go fit prepare my response."

Who be Daniel Bwala?

Daniel Bwala, na lawyer, public affairs analyst and politician for Nigeria.

Dem born Bwala for Borno state wia im study from primary school to university level.

Bwala na graduate from University of Maiduguri for 2006, and e attend Nigerian Law School for Bwari, Abuja.

E don work wit Law Firm of J-K Gadzama & Partners LLP, one of di leading Law Firms in Nigeria for five years, until 2013 wen e comot to go set up im own law firm Bwala & Co.

For 2008, Bwala participate as Observer/Shadow Judge for di International Negotiation Competition (INC) University of Westminster, London, UK.

For 2009, e become Nigerian National representative to International Negotiation Competition (INC).

By 2014, Bwala earn Master of Laws (LLM) for International Business Law from Coventry University and become member of di English bar as barrister by di Honourable Society of Lincolns Inn.

For 2022, presidential candidate of di People Democratic Party (PDP) and former vice president of Nigeria, Atiku Abubakar appoint Daniel Bwala as tok-tok pesin for di 2023 presidential election.

By July 2024, Bwala tok say im don comot from PDP to go join di ruling party All Progressives Congress.

Upon joining APC, Oga Tinubu appoint Bwala as Special Adviser.