Why President Tinubu approve Bwala, Dare as co-tok tok pesins wit Onanuga

Wia dis foto come from, Daniel Bwala/Bayo Onanuga/Presidency
Nigerians on social media don dey chook mouth on top di mata of President Bola Tinubu appointing three pipo as im tok-tok pesins.
Na Bayo Onanuga wey be Tinubu special adviser on information and strategy publish one statement for im X handle wia e tok say "single individual tok-tok pesin for di Presidency no go dey, instead, all di three Special Advisers go collectively serve as spokespersons for di govment".
Di three pipo na Onanuga, Sunday Dare and Daniel Bwala.
"Sunday Dare – wey formally be di Special Adviser on Public Communication and National Orientation go now be Special Adviser, Media and Public Communications.
"Daniel Bwala – wey dem bin announce last week as Special Adviser, Media and Public Communication, go now be Special Adviser Policy Communication," Onanuga tok for im statement.
Dare na di former Minister of Sports but President Tinubu don scrap dat ministry, while Bwala na di former tok-tok pesin of former Vice President Atiku Abubakar during di 2023 presidential campaign.
Bwala replace Ajuri Ngelale, di former Special Adviser on Media to Tinubu who bin resign sake of personal reasons. At dat time, BBC Pidgin bin predict say Tinubu fit choose Daniel Bwala or Sunday Dare to replace Ngelale and dat na how e don happen.
But why e dey necessary for three pipo to dey speak for di presidency?
End of Di one wey oda users dey read well well
"Dis approach na to ensure effective and consistent communication of govment policies, decisions, and engagements," Onanuga tok.
Wetin Nigerians tok?
Unda previous administrations, di President dey get at most, two tok-tok pipo, one go be Special Assistant and di oda go be Senior Special Adviser.
Many Nigerians on social media dey ask why e be say na dis administration wey don tok say dem go cut down significantly on goment spending, na dem dey appoint more pipo to dey do di same work.
Genevieve Mbama on Twitter ask: "But it used to be 2 pipo under previous govment and one under Yar Adua and GEJ. Why 3 now wen economy dey for crisis?"
Anoda pesin wey im X username na @TheHeroNG also echo di same sentiment as e tok say "Three of you doing di same job. So much for cutting di cost of governance".
Apart from Onanuga, Dare and Bwala, President Buhari also get many oda Special Assistants connected to media, publicity or information.
Some of dem include: Fredrick Nwabufo - Senior Special Assistant on Public Engagement; Abdulaziz Abdulaziz - Senior Special Assistant on Print Media; Tope Ajayi – Senior Special Assistant on Media & Public Affairs, etc.












