'Di armed men wey reach 100, burn houses and begin kill anytin wey dem see' – Eyewitnesses tok about 'Kwara massacre'

Witnesses of Woro community attack for Kwara state don tell BBC say about 100 gunmen attack di community on Tuesday evening. But na until Wednesday di toi begin spread.
Di witnesses tok say di happun sudddenly as di men wey carry different dangerous weapons put fire for dia houses - sotay di villagers no get wia to run go.
Abdulahi Umrah Usman, former Nigeria Union Teachers chairman for Kwara state, tell BBC say di gunmen kill many pipo for di community and dem still dey look for many bodies in di community.
E tok say di Islamic extremist kill residents of several communities for Kwara state under di pretense of religion.
"Dem burn so many houses, as I dey follow you tok some of di houses still dey burn, di whole of di community no get shelter," e tok.
"E dey so sad say, if you enta di community now, e go be like say nobody dey di community," .
"Di village head for dat community dem kill im two pikin, wey be graduates bifor dem allow am to escape.
"Dem kidnap im wife and children togada wit oda women from di community."
"Apart from di 75 bodies wey we recover we still get more dead bodies for di bush, some pipo don pick dia corpse into dia community."
E tok say for di past weeks dem don dey get di signal for di community as di gunmen attack neighbouring communities and kill pipo.

Usman add say dem neva experience dis kain incident bifor in di community and e fit becos of di minning in di community.
Anoda witness for di community, Dauda Bahir, CPS to di chairman of Kaiama local govment tok say di bandits attack di community wearing military camouflage.
"Bandits enta Woro community around 17:00 GMT (5:00pm to 6:00pm Nigerian time) dem enta straight di village head compound, dem abduct im second wife and three children and afta dat dem enta di community and kill ova 75 pipo, male and female" e tok
"We bury almost 30 corpse today, bifor our arrival dem don bury many as well. E don happun for di community bifor but e no reach dis level."
"Dem massacre evribodi dia, we neva experince dis for Kaiama local govment bifor."
" Na pure massacre" Kwara state govnor

Wia dis foto come from, Abdulrahman Abdulrazaq/Facebook
Kwara State govnor AbdulRahman AbdulRazaq visit di community on Wednesday night wia e describe wetin happun for Woro community as "pure massacre."
E tok say di bandits enta di comunity through di Niger State border and kill about 75 pipo.
E tok say di citizens suffer from religion ideology but di killings wey happun for di community dey strange to di community members.
Di govnor tok say afta di attack di gunmen go back inside di forest from Niger state and dem dey track dem.
"E dey different from wetin we dey see, wia dem dey kidnap subjects for ransom. Dis na pure massacre, and na sometin we truly condemn and commiserate wit you ova," e tok
"We don bury seventy-five. We dey short of words, but we thank di security agencies for dia work."
"We get challenges of non-state actors from all international borders across Kwara state."
Di attack don happun bifor - Kwara lawmaker
Saidu Baba Ahmed, wey dey represent Gwanabe/Gwaria constituency for Kwara state tok say di gunmen abduct 38 pipo including women and children, di wife, two children and one grandchild of di community ruler dey among di victims.
Di lawmaker tell BBC say dem don bury "about 78 pipo" for mass grave on Wednesday evening.
E tok say dem still dem discover more deadibody wey dem neva bury finish and dem neva know how many pipo wey don die but atleast estimate of 170 pipo don die.
Oga Ahmed tok say Boko Haram don bin write to di communities for di village say dem wan preach to di pipo but becos of dia refusal dem attack di locals.
E tok say dem call security officials make dem protect di community but dem no attack di community but afta dem di security officials commot for di community dem attack di community members.
Di lawmaker also tok say di group don attack di community for di scond time and di first attack ahppun early last year.
E confam say di community na mostly Muslim, about "99.9%" of di residents dey practice Islam.
Nigeria govment blame Boko Haram

Wia dis foto come from, Getty Images/Emmanuel Arewa
Nigeria say na terror group, Boko Haram cause di attack wey kill dozens for Woro and Nuku communities for Kwara state,.
President Bola Tinubu for statement wey come out on Wednesday condemn di "cowardly and beastly attack".
E describe di gunmen say dem no get heart for choosing soft targets for "dia doomed campaign of terror."
Di presidency also call for closer cooperation between federal and state agencies to support di communities wey dey affected and to make sure say dem find di pipo wey commit dis "atrocities no go scot-free."
Amnesty International don also condemn di violence. Dem tok say "Nigerian authorities must effectively and impartially investigate dis attacks and do more to protect all lives."
Di rights group wey criticize di security agencies, tok say "di security lapses wey enable dis attack dey unacceptable."
Amnesty International findings show say di gunmen don dey send 'warning' letters and pamphlets to di community for ova five months — and as recent as two weeks ago."










