Family confam di death of actress and comedian Aunty Ajara

Foto of Aunty Ajara

Wia dis foto come from, AuntyAjara/ Facebook

Read am in 3 mins

Popular actress and comedian, Ajara Lasisi wey pipo sabi as Aunty Ajara don die afta battling health issues.

Ajara Lasisi, wey dey popular for di Yoruba film industry die on early mor-mor on Thursday.

Di family confam di heartbreaking news to tori pipo but we no know di exact health issues wey lead to her death.

Ridwan Lasisi, wey be di deceased broda announce di death for one emotional video.

Ridwan extend appreciation on behalf of di family for di support dem receive from her colleagues in di feem industry and fans.

"Good morning everybody. My name na Ridwan Lasisi. I be Ajara elder broda, Doctor don confam dis morning say Ajara don die," e tok.

"All di family, we dey use dis period to appreciate you all. We appreciate di president and all industry members.

"We dey use dis opportunity to appeal to pipo wey dey send money, make una no send am again."

Di actress health issue come to di public last week afta her colleague for di industry Ronke Oshodi-Oke come out to appeal for support.

Oshodi-Oke tok say she dey for hospital in critical condition and she dey use oxygen machine, and her health dey worse despite all di medical care.

Di actress colleagues and fans don send dia condolence to di family.

Anoda colleague to di actress, Tobi Oladele send im condolence to di actress Aunty Ajara family.

"She pass on overnight afta long and courageous battle wit illness," Iamteemony tok.

"During dis difficult period, Ajara receive plenti love, prayers, and financial support from kind-hearted pipo across di world.

We dey deeply grateful to everyone wey stand by her wit prayers, contributions, encouragement, and compassion.

Our thoughts and prayers dey wit her family, loved ones, and everyone grieving dis painful loss.Make her soul rest in perfect peace," e tok

One of di fans of di actress, @OladejiIsaac14 ontop im X page tok say she be symbol of strength, resilience and hope.

"Aunty Ajara na more dan actress, she be symbol of strength, resilience, and hope. Her talent, talent, warmth, and courage touch many within and beyond di Yoruba Nollywood community," e tok.

"Make God give her family, friends, and all those wey love her di strength to bear dis great loss."

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

About Ajara Lasisi

Foto of Ajara Lasisi

Wia dis foto come from, AuntyAjara/ Facebook

Dem born Lasisi "Aunty Ajara" Ajara wey pipo sabi becos of her comedy and small stature for Ogun State.

She begin her career for Yoruba movies but die on February 5, 2026 afta one sickness wey bin start for December 2025.

She spend weeks for hospital, dey fight for her life. Her colleagues bin post videos wishing her di best of health bifor she die.

Aunty Ajara feature in many movies including 'Gingerrr', 'Queen Lateefah', and 'Isiti' alongside actors like Toyin Abraham, Adeniyi Johnson and Wumi Toriola.

Aunty Ajara dey inspire many pipo wey get small stature like her sef for di industry.