Police begin investigation, Destiny Boy mama tok wetin kpai am, papa raise concern ova SUV - oda tins wey don happun since singer death

Destiny Boy

Wia dis foto come from, @iam_destinyboy/Instagram

Read am in 4 mins

Police for Nigeria don begin investigation into di death of popular Fuji singer Afeez Adesina wey pipo sabi as Destiny Boy as fresh details continue to come out from im family and public afta di singer death at di age of 22.

Di Ogun State Police Command confam say dia homicide section dey handle di case and say dem don make one arrest.

Inside statement wey dem release on Monday 19 January, di police say investigations dey go on and dem no disclose further details about di suspect or di circumstances wey surround di death.

"Di Ogun State Police Command don since commence investigations into di death of Adesina Afeez, aged 22 years, popularly known as Destiny Boy.

"Di case don dey transferred to di State Criminal Investigation Department (SCID), Homicide Section, for detailed investigation. One suspect currently dey for custody while investigations dey go on," di statement tok.

News of Destiny Boy death break on Sunday 18 January and quickly spread across social media and trigger shock, grief and widespread speculation. Family of di singer don bury am according to Islamic rites.

Destiny Boy mama tok wetin kpai am

As di rumours of wetin kill am dey circulate online, Destiny Boy mama, Saida, release one video on Monday 19 January wia she address di cause of her son death.

She say di singer bin don dey battle long-term illness wey dey always cause seizures.

According to her, di illness, locally referred to as "Ogu oru", bin don persist for years and require both medical and traditional treatment. She explain say di family bin take Destiny Boy to several hospitals and also seek traditional remedies so dem go fit stabilise im condition.

"We bin no let di public know about dis becos na superstar. We take am to churches, herbalists, etc for am to get a cure but no level," she tok.

Saida say di seizures sometimes become severe, and e dey force di family members to restrain am so e no go run into danger. She dismiss claims wey dey circulate online say di singer bin dey involved for money rituals, and she describe such allegations as false and hurtful.

She add say Destiny Boy bin dey active and dey interact wit fans just a day bifor im death, and bin even mention plans to perform for one show on Sunday bifor im condition reportedly worse again.

Papa raise alarm sake of missing SUV

For anoda development, di singer papa don appeal to di public for help ova di disappearance of im son SUV, days afta im death.

For one video on social media, Destiny Boy papa say one driver don return di SUV to di dealer wey di singer buy am from witout di family knowledge. E explain say e bin follow im son to buy di vehicle and add say di dealer bin provide driver to drive am home on di day dem buy am.

According to di singer papa, Destiny Boy later retain di same driver for personal use. E say problem start wen di driver claim say di singer owe am money and return di SUV to di dealer. Di papa say im no get di driver contact and neva dey able to locate di vehicle since.

E call on Nigerians to assist am to trace di SUV, and add say di situation still dey shake di family,

Social media reactions

Destiny Boy death don continue to generate intense reactions online.

Videos wey show im body as dem dey transport am to mortuary don circulate on social media cause speculation and conspiracy theories about wetin fit don kpai am.

Some social media users question di handling of di case, while odas dey demand transparency.

Oda social media users express concern ova di lack of post-mortem examination bifor dem bury di singer.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Who be Destiny Boy?

Destiny Boy

Wia dis foto come from, @iam_destinyboy/Instagram

Afeez Adesina aka Destiny na fast rising Nigerian Afrofuji singer wey dem born on June 24, 2004.

Bifor im death on Sunday 18 January, im be one of di most promising young talents for Nigeria music scene. E dey fuse Fuji music wit contemporary Afrobeats.

E break into di spotlight for 2019 wen im Fuji-inspired cover of Davido hit song If bin go viral on social media, and make am popular at di age of 15 years old. Di success bin mark di start of im music career as e release original songs, reinterpret popular hits and perform for audiences across Nigeria and beyond.

Destiny Boy die for Ijebu-Ode, Ogun State, southwest Nigeria. E leave behind a partner and dia pikin wey dem born for November 2024.