Mohbad wife reveal why dem neva do son DNA test as father-in-law wan change im lawyer

A couple with their child

Wia dis foto come from, @_C33WHY_/INSTAGRAM

Read am in 8 mins

Mohbad wife and im father don dey inside long dragging as to wen dem go do di DNA test of di only son wey di late musician born bifor e die.

Afta one year wey di mata of ogbonge music artiste Ilerioluwa Oladimeji Aloba aka Mohbad bin happun, im body neva dey laid to rest and di issue of DNA dey cause more worry.

Mohbad mysteriously kpai for 12 September 2023 and since dat time e neva clear wen dem go bury am again afta dem bin exhume im remains for autopsy.

Afta di mata end for di coroner inquest to find di cause of death of Mohbad, di result wey come, show somtin wey shock di public.

However, as di coroner inquest dey go on, di issue of DNA come up wia Mohbad father, Joseph Aloba demand say im wan confam who be di father of im grandson.

BBC News Pidgin tok to Mrs Wunmi Aloba wey be Mohbad wife through her lawyer and di father-in-law wia dem reveal wetin dey hold di DNA test and di latest tori ontop di autopsy result.

'We dey ready to do DNA test' - Mohbad wife

Mohbad

Wia dis foto come from, @IAMMOHBAD/INSTAGRAM

Anoda big gbege wey pipo dey chook mouth ontop na di issue of DNA. Dis na afta Mohbad papa bin demand say e wan know who di true papa of Liam be.

For one interview wit BBC News Pidgin, Joseph Aloba tok say im want make dem do di DNA for im grandson.

Di papa and im legal team begin file say make Wunmi carry di pikin come for DNA.

However, Wunmi Aloba say she don ready to do di DNA test since but di father side wey suppose show face neva show for dem to do am.

She lament say dem dey drag di issue of di DNA like say na she dey hold am but na di papa no show for dem to go do di test.

According to Wunmi lawyer, she sure say her son no be bastard. She say since di court grant Mohbad papa di consent judgement to go do di DNA, dem no hear anytin again.

"For di DNA, we ready. Dem file and our client say she no get anytin to hide becos di child no be bastard. We write to dem say make we do DNA and di court give consent judgement to do di DNA.

"At di end, we wait and up till today, we no hear anytin about di DNA. We tell dem say if dem wan take samples, dem go bring Liam come anytime but we no hear anytin."

Wunmi lawyer say dem go go ahead to do di DNA test if di papa no ready to step forward to make di process fast. E add say dem go serve di father side wit notice and if dem no show up, dem go go ahead.

Meanwhile, e add say na Mohbad father side (Mr Joseph Aloba) dey cause di delay becos e know say if dem do di DNA, "all dia noise and attention go end for social media".

Wunmi through her lawyer say dem go provide di son wen dem want collect samples for di DNA and if di papa side no ready, dem go pay di fees and conduct dia own, so as to clear dia name from di mess wey pipo dey drag dem into.

Dem go take di son samples and den take samples of Mohbad. Even if na 300 years, dem fit take di sample to conduct DNA.

"Within 6 weeks, we suppose get di results. Dem gatz collect samples and take am abroad. We go also pay di fee becos we wan clear our clients and her son name.

Anoda tori wey we also hear be say Mr Joseph Aloba (Mohbad papa) say e wan dey di life of im grandson if di result dey positive, but make dem no carry di result go media.

'Mohbad father dey run'

For one letter dated 9 January 2025, lawyer to Mrs Wunmi Aloba (Mohabd wife) bin serve notice to di father-in-law through im laywer Mr Taiwo Odumosu ontop di DNA mata.

Barrister Akingbolu, for di notice wey e serve lawyer to Mohbad papa, say Mohbad papa wey wan make dem do di DNA, na im dey run but e dey go social media go tok bad about im grandson.

Di lawyer say Mohbad papa dey speak bad about Liam (Mohbad pikin) for social media wey no suppose be so.

"About three weeks ago, we bin see di applicant (Mr Joseph Aloba) dey spoil di name of Master Liam and as e dey do e dey call am bastard, and we no go accept dis especially as di court don ask make you go conduct di DNA but e dey run away.

"We want make you take steps to ensure say we timely conduct di DNA so we fit make progress."

"If your client prefer empty social media hype for bad reasons we go get no oda option dan to conduct di DNA by oursef," Barrister Akingbolu tok.

Wunmi lawyer say dem go make di result of di DNA public for pipo to see and dem go inform di court about di outcome.

Lawyer to Mohbad father reply

Meanwhile Mr Taiwo Odumosu for im response tok say na di hospital wey dem wan use do di DNA neva respond to dem to conduct di test.

For im letter dated 11 January 2025 through im chamber Hillceete Partners, Mr Odumosu wey be Mohbad papa lawyer tok say dia chamber no dey represent Mohbad father again.

"Dis response dey necessary as we respect your good sef and to set di record straight as our chambers no longer dey represent di applicant."

'I wan change my lawyer' - Mohbad papa react

We reach out to Mr Joseph Aloba (Mohbad papa) for im own side of di tori, e say no be im dey delay di DNA process but di hospital wey dem contact neva give dem reply.

"No be me dey delay, my lawyer don write to di places wey we sabi say e good to do di DNA but we no get reply."

Mohbad papa say na new lawyer go take ova di DNA case sake of say e wan change im lawyer to anoda one.

"I wan change my lawyer, na my new lawyer go take di case. We need to do am, if we no do am now, e no go dey possible again.

E add say once di new lawyer take ova di case, e no go tey wey dem go do di DNA test.

On di tori of if e go accept Liam as im grandson if di DNA result dey positive or not, e say e go be happy moment for am if Liam na im grandson true true.

"Anytin we do, di whole world go hear, we no fit keep am secret. I wan make di world know.

"I want make pipo know say na happiness to me if na my grandson true true, but as head of family, I gatz know," e tok.

Mohbad autopsy result

Barrister Kabir Akingbolu wey be di lawyer to Wunmi Aloba and her son, Liam, say wen di result of di autopsy bin come, dem question am but di pathologist say di cause of death dey unknown.

Remember say BBC News Pidgin bin monitor how di bodi of Mohbad take comot from wia di police dig am out for Ikorodu kon carry am go Lagos State University Teaching Hospital (Lasuth) for 21 September 2023 - for autopsy afta public cry.

Wunmi lawyer say di pathologist tell dem say dem suppose don take di sample of Mohbad body bifor dem bury am, at least 24 hours afta e die.

"We ask say why di cause of death no go dey known, e say you fit only sabi di cause of death of anybodi if dem collect di sample of di pesin within 24 hours, say di whole bodi go don dey spoil afta dat time."

Di lawyer wey also dey present for di court say di pathologist mention say dem examine di bodi, di kidney, di liver, di spinal cord for di autopsy but blood no dey again.

Afta dat, di papa of Mohbad say e no go accept di autopsy report and e wan do independent autopsy report and court grant dem di request.

Dem take di samples and say result go come afta six weeks, but e don pass six months now and no report.

Di lawyer say since di father no show any oda result from di autopsy, e mean say no contrary report to wetin di pathologist bin submit to di court.

Wit dis gbege, e mean say dem no know di cause of Mohbad death, according to di autopsy result.

Wen dem go bury Mohbad?

Di father of di late Afrobeat star, Mohbad say im family bin dey wait for di DNA and autopsy result bifor dem go bury di musician.

Now wey result come out, dem no gree for wetin di result tok and dem wan do dia own independent autopsy.

Wit all dis gbas-gbos wey dey go back and forth, e no clear wen di bodi of late Mohbad go enta ground again for di final time.

Meanwhile, Wunmi lawyer reveal say one NGO don go obtain court judgement say make dem pause di legal proceedings ontop Mohbad case.

Barrister Akingbolu say di court order "say make we stay proceeding", wey mean say di court proceedings go stop.

Maybe na tomorrow dem go bury Mohbad, or na next month or next year- nobodi sabi except di family as di bodi dey lie for morgue.

But one day, dem go pay last respect to late Mohbad so e go fit go rest in peace.